Lebanon before and after explosion: Beirut explosion disaster casualty dey increase, Lebanese Red Cross tok – See wetin di Middle East city look like, plus world reactions

Lebanon explosion

EPA
Destroyed vehicles after di blast for di port of Beirut on4 August

Di death toll from Lebanon explosion on Tuesday don rise to at least 100 according to Lebanon health ministry, while 4,000 odas na im injure.

Lebanese Red Cross tok say dem dey worried say di number of casualty fit rise pass 100 deaths as many pipo still dey miss from di blast wey happun around 15:00 GMT.

Currently, rescue workers dey search rubble for di port of Beirut wia di explosion happun after di deadly blast.

Red Cross tanda dey coordinate wit di Health Ministry to set up mortuary because hospitals don full boku, one rescue worker tell Reuters.

Sara wey be nurse for Beirut Clemenceau Medical Center, describe wetin she see for her hospital afta di blast as “like a slaughterhouse, blood dey cover di corridors and di lifts”.

Dis na wetin Beirut look like today afta Lebanon explosion

Lebanon explosion today

AFP
Lebanon explosion today

AFP
Lebanon explosion today

AFP
Explosion in Beirut Lebanon

AFP
A general view shows the damaged grain silos of Beirut’s harbour and its surroundings

Tori be say na 2,750 tonnes of ammonium nitrate wey dem bin store unsafely inside one warehouse inside di port of Beirut cause di heavy explosion wey show mushroom cloud.

Na pesin bin try to import di ammonium nitrate chemical compound for 2014 but authorities impound am. Na dia dem begin investigate di mata, cari am go court. Di mata still dey for court before dis blast happun at about 15:00 GMT on Tuesday.

Di meeting of di Higher Defence Council, wey President Michel Aoun chair recommend say make di goment declare a two-week state of emergency inside di capital Beirut wen dem hold cabinet session on Wednesday.

Lebanon explosion today

AFP
Lebanon explosion today

Reuters
Lebanon explosion today

AFP
Lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
lebanon explosion today

Getty Images
Lebanon explosion today

Getty Images

Even before Tuesday tragedy, Lebanon bin don already dey suffer under a number of major crises.

Di kontri currency don dey lose value against di dollar in recent months, leading to inflation and difficulties accessing basic goods.

On top of dis, Lebanon bin don dey deal wit major power cuts and oda problems over basic services.

Growing anger last year bin lead to mass protests against di big ogas for di kontri alias elite, wey eventually remove di goment.

Coronavirus don also make tins worse.

Di goment bin implement strict lockdown wey dem be relax for short period before dem reinforce am again.

Contains scenes which some viewers may find upsetting. – “Now I’m shaking, all the way from up to down” – Eyewitnesses describe the power of the explosion
The British Broadcasting Corporation

How pipo dey react

World pipo dey react for social media wit different hash tags like #prayforbeirut #PrayForLebanon sake of di wetin happun for di port of Beirut inside Lebanon.

United Kingdom

UK Prime Minister Boris Johnson express im readiness to help Lebanon in any possible way.

Even di Queen of England send sorry message to di pipo of Lebanon.

United States

President Donald Trump don send im sympathies to Lebanon for di dozens of pipo wey don die and thousands wey wound inside di blast, wey di US President describe as attack, and offer US help.

France

French President Emmanuel Macron express solidarity wit di Lebanese and tok say France dey send resources to di site of of blast.

Germany

Di German foreign ministry say staff for di German embassy wound inside di explosion.

Iran

Iranian Foreign Minister Javad Zarif say Tehran dey ready to assist in any way and advice Lebanon to “stay strong”.

Qatar

Qatar Emir Sheikh Tamim bin Hamad Al Thani call President Michel Aoun to offer im sorry message, according to di state-run Qatar News Agency. Di Gulf kontri say dem go send field hospitals to support Lebanon medical response.

Saudi Arabia

Saudi Arabia foreign ministry say dem dey follow with great concern di consequences of Beirut port explosion.

Malaysia

Malaysian Foreign Minister Hishammuddin Hussein express im kontri grief sake of di Beirut blast, and offer to help in “any way dem fit”.

Israel

Israel wey dey share common boundary wit Lebanon say dem don offer humanitarian aid to Lebanon through foreign channels, as di neighbours no diplomatic relations.

BBC Arabic office bin also shake gbim-gbim-gbim

See oda tori dem wey you fit read: