Coronavirus Lockdown update: Lagos goment don give greenlight for places of worship to reopen on 7 August

Lagos state govnor Babajide Sanwoolu don give greenlight for places of worship in the state to reopen from August 7th .

Govnor Sanwo-Olu disclose dis during di briefing on COVID-19 for Lagos House in Marina.

Goment bin don close down places of worship since March as part sake of to prevent di spread of coronavirus.

Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri but di Lagos State goment no gree allow worship centres for di state to reopen.

Now govnor Sanwoolu tok say while mosques fit reopen from Friday August 7, churches go follow suit on Sunday, August 9.

“Places of worship in Lagos go now open from Friday, 7th of August for our Muslim worshippers, and on Sunday, 9th of August for our Christian worshippers.” Govnor Sanwoolu tok.

“We go allow only 50 per cent of dia maximum capacity, either for church or mosque. Churches wey dey worship on Saturdays go also dey allowed to hold worship.

“Place of worship must to have dia regular once a week service on days dem choose.

“We go monitor this for di next couple of weeks and see how dem dey observe am. We dey encourage dem to have multiple services on those days but it must dey restricted only those days of worship.

“Regular gatherings dey permitted to hold but vigils and other services go still dey on hold for now.

But di govnor draw ear give old pipo. “We recommend and seriously beg our senior citizens – if you be 65 years and above, we strongly advise say make you no attend these places of worship. Please stay for house.”

According to him, religious leaders must to make available hand sanitisers, handheld thermometer checks.

Oda key tins di govnor tok

Di govnor don also increase di number of pipo wey dey gather from 20 to 50. E add say di state government go ensure say social distancing dey maintained.

E also announce say Secondary schools for di state fit also reopen from August 3rd but dis na for those wey dey for examination classes.

E give news say pipo go fit dey enta restaurant siddon chop from August 14 but make dem follow all Covid- 19 health protocols.

According to di Nigeria Centre for Disease Control as of Friday night, Lagos record ova 15,000 Covid-19 infections and about 200 pipo don die.

Lagos na im get di highest number of coronavirus cases for di kontri.

Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19
The British Broadcasting Corporation

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.