Nigerian schools resumption update and Waec timetable for August 17: FG okay NECO exam to start October end November, release national examinations schedule for candidates

NECO: Waec timetable for August 17

Getty Images
Almost half of di students wey write WAEC dis year fail Maths

Nigeria federal goment on Wednesday fix 5 October to begin di Senior Secondary School Certificate Examinations (SSCE) wey National Examination Council (NECO) dey for SSS 3 students.

Di National Common Entrance Examination (NCEE) into Unity Colleges go hold on 17 October, 2020, according to statement issued by Director of Press and Public Relations, Federal Ministry of Education, Ben Goong.

Dis national examinations schedule wey Federal Ministry of Education release, follow meeting on Tuesday 28 July dem do wit di joinbodi of Chief Executives of examination bodies like NECO, NABTEB and NBAIS.

Waec timetable for August 17

Getty Images
Nigeria schools reopening and Waec examination timetable latest update

Di statement add say Basic Education Certificate Examinations, (BECE) for JSS 3 pupils wey NECO, dey organize go start on 24 August, and end on 7 September, 2020.

E say registration for di NECO SSCE, dey dey on-going, go end on 10 of September, 2020 wit no option of extension.

Nigerian goment bin close down all schools across di kontri sake of coronavirus out break. Last monday Nigeria goment tok say secondary schools for di kontri fit reopen as from di 4th of August, 2020.