Daniel Domelovo: Ghana govment force Auditor-General to go on 167 days leave as ‘unknown powers’ change key locks on en office

Barely one month into directive to take en forced leave, Auditor General (AG) no fit access en office.

Daniel Domelovo discover say dem change de lock and keys on en office doors as he try enter on Tuesday to check some files.

President Akufo-Addo direct Mr Domelovo to take en accumulated of 167 days, but de latest action dey raise questions among Ghanaians on why dem for change en office locks.

Inside video wey dey circulate, de Auditor General dey try put keys inside de door lock but e no fit enter.

How dem lock Ghana AG office

On June 29, President Akufo-Addo direct Daniel Domelevo say he for take en accumulated leave of 123 days.

But de Auditor General who express en unhappiness over de forced leave directive write open letter to govment which make dem include en 2020 leave, increasing en leave days to 167.

People raise concerns over de forced leave which dem say be move to silence de AG who be major anti-corruption fighter for Ghana.

At de time dem ask am to proceed on leave, Mr Domelovo cite Senior Minister, Yaw Osafo-Maafo say he cause financial loss to de state to de amount of some $1 million in some Kroll Associate deal.

Speculations wey emerge be say de forced leave be move to stop Mr Domelovo from exposing Yaw Osafo-Maafo.

Claims be say dem change Mr Domelovo en office keys so say he no go fit pick documents or leak documents which go fit embarrass govment.

But question wey everyone dey ask be where dis instruction to lock en office dey come from?

Who be anti-corruption crusader, Daniel Domelovo?

Former President John Mahama appoint, Daniel Domelovo as Auditor General of Ghana around December 20, 2016 after he lose de elections.

Dis happen few days into de formation of a new govment by de New Patriotic Party wey win de 2016 elections.

Mr Domelovo since en appointment lead de fight against corruption in a fearless manner wey make people consider am as a true anti-corruption crusader.

In 2019, Ghana Intergity Initiative (GII), de local chapter of Transparency International adjudge Mr Domelovo as Integrity Personality of the Year to recognise en contribution to anti-corruption, procurement breaches within state institutions.

Mr Domelovo come make popular for en statement “fighting corruption be dangerous, if you fight corruption, corruption go fight you back in whatever way.”

Ghana govment at de time dem ask am to take en forced leave talk say nobody sack am, dem just want make he take en leave in accordance with good governance practices.

But more Ghanaians dey speculate say de issues surrounding de AG en forced leave, locking of en office den stuff be plot to sack am.