Big Brother Naija: Wetin we learn about Nengi, Kiddwaya, Ozo and di lockdown housemates from dia ‘Truth and Dare game’

18 out of di 20 housemates inside di Big Brother Naija lockdown house dey up for possible eviction dis week afta Biggie introduce new twist for di game dis season.

Na only di Head of house Lucy and her deputy Prince wey get immunity for di house.

But di housemates no allow di whole nomination walaha spoil dia mind at all. In fact dem decide to ginger demself with di game of “Truth and Dare”.

As with di tradition for di house Neo take charge of di game with di title of oracle and set rules on how dem go run di game.

See wetin we learn from di housemates ‘Truth and Dare’ game on Day 8 for di reality television show.

Kiddwaya pick Erica as di girl im go like date for di house

Wen im fellow housemates dare Kiddwaya to kiss someone for 30 seconds. Di 26 year old from Benue state no waste time to to let pipo know wia im heart dey.

Im waka straight go meet Erica and di two of dem share dia first kiss for di reality television show.

Ozo give Nengi lap dance

Wen Nengi dare Ozo to pick any girl for di house to give lap dance for 30 seconds, Ozo response no too surprise plenty pipo.

E say na only one girl wey im fit give lap dance for di house and dat girl na Nengi.

Him do im dare as housemates cheer am on.

More dares

No be every Housemate wey dia luck shine to kiss somebody wey dem like but dem do oda interesting dares too. Ka3na lick Neo nipples.

Brighto own dare for di night na to lick Tolanibaj ear. Anoda housemate wey also do im own dare na Trikytee, im touch Tolanibaj breast.

Meanwhile dem neva evict any housemates yet for di reality show wey start on Sunday 19 July.

Di show host Ebuka Obi-Uchendu announce during di show say dis season nominations go different.

E say Big Brother don introduce new eviction twist. Di new twist wey Biggie introduce na to put all housemates up for possible eviction. Na only di Head of House and Deputy Head of House wey go get immunity.

Even though Biggie don set all dis rules for di house, some housemates don begin dey chewing gum demself inside di house.

Relationship, situationship and entanglement na wetin fans dey take describe some of di hook ups wey dey happun inside di Big Brother Naija season 5 lockdown house.

See some of di ‘relationships’ wey fans dey tok about for di reality television show.

Entanglement?

One of di most talked about relationship inside di house na di one between Ozo, Nengi and Dorothy

On Sunday during di Live eviction show, Ebuka ask Ozo about im relationship with di ladies, im say Dorothy na im friend inside di house e add say im dey attracted to Nengi.

Meanwhile Dora bin don already tell Ozo earlier in di week say “I no like dis situation and I go remove myself from am,” na wetin she tell Ozo.

Relationship

“Even though I know say I want to dey involved with a lady when I enta di game, I no expect us to dey dis close dis fast,” na wetin Eric tell Neo.

Eric and Lilo begin dey close to each few days afta dem enta di house. Di two of dem dey always spend time togeda for di house.

On Saturday dem share dia first kiss togeda for inside di reality show.

Situationship?

Di oda relationship wey surprise fans well-well na between Neo di Warri boy and Vee di London girl.

Neo tell Eric about im own situationship palava, for inside di house but e make am clear say dis love mata wey im dey about to enta no go distract am from di Big Brother game.

E say, “Your own no quick pass my own.” Na wetin Neo tell Eric.

“She don already set her mark, she ask me to be her bestie and give her a massage.” Na wetin im add put.

Meanwhile di oda relationship wey fans dey look with side eye for di house na di Kiddwaya, Erica and Wathoni circle.

Kiddwaya and Erica don begin gum each oda. On Friday wen Erica bin dey cry inside room Kiddwaya go console her.

But e be like say Wathoni like di 27 year old from Benue, afta dia Saturday night party during dia truth and dare game im kiss Wathoni.

Wit weeks of plenti drama, romance, Friday night games and di popular Saturday parties, di Big Brother Naija reality TV don produce ogbonge celebrities since e start di first edition for 2006.

Dis season 20 housemates dey compete for di grand prize of N85 million naira.