Kanye West Bipolar disorder: Mental illness fit happun to anybody – Why dis celebs open up about dia own

Many pipo wey no too sabi wetin mental illness really be go dey surprised when Kim Kardashian, di wife of US rapper Kanye West tok about her husband bi-polar condition.

But di fact be say mental illness na something many pipo dey face and na different-different ways e dey show for pesin body – e.g depression, bi-polar disorder, post-traumatic stress disorder and eating disorders.

World Health Organisation say most of di problems wit mental health get treatment.

US rapper Kanye West

PA Media

According to study wey one sabi pesin do, e torchlight say for Nigeria, na like 20%-30% of di population dey suffer from one mental problem or di oda.

If di report get any truth inside, why e be say many pipo no dey come out to tok about dia struggle? One answer fit be say di culture of many African kontries wey dey look anyone wit mental problem wit one kain eye or stigma as dem dey call am.

But for di yonder, celebrities don begin comot to show di world say shame no suppose dey for pesin wey dey struggle wit mental illness. Make we torchlight some of dem:

Trevor Noah

South African comedian Trevor Noah tok about im struggle wit depression inside one 2017 interview.

“I feel say many pipo no sabi wetin e really be. So when dem say you dey suffer from depression pipo tink say you go dey sad all di time. Na one chemical inside your brain wey make you begin feel say wetin dey happun to you now, go happun forever,” tok Noah wey don recover now.

Taraji P Henson

For 2019, ogbonge actress from di tv show ‘Empire’ reveal how she struggle wit depression and anxiety, and say she no know on time say na her menopause dey cause am.

‘Cookie’ as dem dey call am for di series, say she prefer to tok to therapist wey go give her treatment and no lie to her. “Sometimes your friends and family no get liver to tell you true about yourself”

Boris Lawrence Henson Foundation wey she start dey named afta her papa, wey dem believe say get bipolar disorder.

Dwayne ‘The Rock’ Johnson

For 2018, Hollywood star Dwayne Johnson thank fans for dia support afta im comot to tok about im battle wit depression.

Di actor wey also be professional wrestler say di time wey im mama bin wan commit suicide na di “worst time” of im life, Johnson bin tell tori pipo ‘The Express’.

“My mama and me dey okay now but we need to dey put ear for ground when oda pipo dey in pain. We need to helep dem in that period and to remind dem say no be only dem e dey happun to.

“You no be di first to experience am; you no go be di last,” im tell Oprah Winfrey.

Man wey use im two hand hold head

BBC
WHO say less than 10% of Nigerians wey dey mentally ill fit get di treatment dem need

Chrissy Teigen

Supermodel Chrissy write tori give Glamour magazine for February 2017, wia she tok about how she suffer postpartum depression afta she born her daughter, Luna.

And why she come dey tok about am now? “I want pipo to know say e fit happun to anybody and I no want make shame catch dem.”

Chrissy Teigen

Getty Images
Chrissy Teigen na wife of musician John Legend

Kerry Washington

For one interview wit Essence magazine for 2009, di Scandal actor tok about how she begin chop anyhow and exercise all di time as way to cope with her own problem.

“I use food as way to cope – e become my best friend,” she tok. “I go chop anything and everything, sometimes until I collapse.

Kerry do therapy with professional therapist – and nutritionist – to help her get treatment.