Isa Funtua death na cardiac arrest cause am – See wetin we sabi about Mallam Ismail Isa Funtu, President Buhari close friend

Isa Funtua wey die on Monday 20 July, na one of di closest pipo to Nigerian President Muhammadu Buhari and dis na some things wey we sabi about di former minister.

One of im relatives wey speak to BBC confam say na heart attack kill Alhaji Isma’ila Isa Funtua.

E yan say di 78 year old complain say e wan see doctor and na im drive himself go see barber first before e later drive to hospital wia di sad tin happun.

  1. NDDC boss collapse for probe hearing

Dem born Samaila for January 1942 for present Katsina State northwest Nigeria, and like many, na Quranic school e first start before e enter western school wia e attend Commercial College Zaria and Ahmadu Bello University.

Alhaji Isma’ila Isa Funtua also attend Manchester University for UK and na im be monitor general for course 9 for Nigerian Institute of Policy and Strategic Studies (NIPSS).

E start work Katsina Native Authority wia e continue dey rise before e later join Kaduna Textiles as personnel manager controlling over 10,000 staff for dia.

President Shehu Shagari later appoint am minister of Water Resources during im tenure and for 1994 General Sani Abacha put am for di Constitutional Conference wey hold dat year.

Na from dia e retire permanently from public office and set up private business, na im be founder of one of di biggest construction companies for Nigeria, Bulet Constructions and also bin set up Funtua Textiles and Democrat Newspaper dis na why e be Life patron of Newspapers Proprietors Association of Nigeria.