Nana Akufo-Addo: President of Ghana go resume work today after 14-day self-isolation for Covid-19 in de West Africa nation – See what Ghanaians dey expect

Nana Akufo-Addo – President of Ghana dey expected to resume work today afta en 14-day self-isolation sake if he make exposed to Covid-19.

De President go inside self-isolation sake of at least one person within en close circles test positive for de virus.

Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah talk journalists say de President dey do well, wey he go start dey work from de Jubilee House on Monday 20 July.

Things Ghanaians dey expect from Prez Akufo-Addo as he resume

• He go start dey address Ghanaians on how govment dey handle de Covid-19 fight.

• He go engage students, teachers and parents on issues surrounding final year SHS students who dey write WAEC exams.

• As part of en official engagements, he go lead Cabinet meetings wia dem dey strategise on economic and development issues.

• He get some engagements outside Accra during de week, according to Information Minister.

• At some point he go try address Ghanaians on de ongoing voter registration exercise den de issues around it.

Dis morning, Prez Akufo-Addo already start dey wish final year students well in dema WAEC exams.

https://web.facebook.com/nakufoaddo/posts/10158496577349836

While Prez Akufo-Addo dey on self-isolation, issues surrounding de voters registration exercise, spread of Covid-19 for senior high schools.

Some observers already dey speculate say another lockdown go fit happen again sake of how de Covid-19 case counts dey increase.

Dis be some of de issues wey Ghana Prez Akufo-Addo go explore to ensure de safety and wellbeing of Ghanaians.