Explosion in Katsina: Blast for Nigeria President Buhari home state kill pipo

Police for Katsina state Nigeria don begin investigate di bomb explosion wey happun today for Yammama village inside Malumfashi Local Government Area of di state.

Police tok-tok pesin inside di state, Gambo Isah tell BBC Pidgin say five young children na im die and six oda pikin injure.

E say: “At about 11:30hrs, DPO Malumfashi report say a loud sound na im dem hear inside di farm of one Alhaji Hussaini Mai Kwai.

Katsina na President Muhammadu Buhari home state wey dey northwest Nigeria.