Nigeria schools resumption latest update on Waec examination

Nigeria schools resumption latest update be say di five west African nations wey dey sit for Waec examinations dey consider to shift di West African Secondary School Certificate Examinations(WASSCE) for August.

Di Minister of State for Education, Chukwuemeka Nwajiuba, yarn say di ministry don meet wit WAEC pipo dem on Monday and dem don agree to consult wit four oda kontries to come up wit a new date for di exam.

Secondary school graduating students wey live for five English-speaking kontries for West Africa na dem dey write di WASSCE, wey West African Examinations Council (WAEC) dey organise.

Dem postpone dis year exam for April sake of di coronavirus outbreak. Dem come move am to May but dat one sef no work.

Nigeria bin announce say student go write di August- September exam but later di education minister, Adamu Adamu bin do u-turn and announce say Nigerian student no go participate for di exam.

Nigeria ministry of education also don give school owners till 29th of July, 2020 to meet goment specific guidelines to reopen schools.

Di Nigerian goment bin release guideline on di 13th of July wey all school gatz follow and implement before dem go open dia doors to school pikin dem.

All school owners gatz prepare to ensure say dem follow di guidelines from A to Z di minister explain.

WAEC in prison

BBC

Although di education ministry release guideline plus, don give time frame for school to comply wit di guideline, no body don know date wey school go resume.

But di ogbonge minister say di education ministry go fit come up wit specific date for school to reopen only if e consult wit all stakeholders and review every situation.

Dis na why di minister want schools to self-assessment and send feedback to State Ministries of Education, on or before 29th July, 2020.

“Since Tuesday last week, we don dey consult widely wit stakeholders for di sector, including Commissioners of Education for all di states of di federation, the Association of Private School Owners of Nigeria,(APSON), National Association of Proprietors of Private Schools,(NAPPS), Provosts of Colleges of Education, Rectors of Polytechnics, Vice Chancellors of Universities, some State Governors, and development partners.” im explain.