Rose Christiane Ossouka Raponda Biography: What you need to know about Gabon first female prime minister

Rose Christiane Ossouka Raponda don become di first female Prime Minister for Gabon.

Gabon President Ali Bongo bin appoint her to replace Julien Nkoghe Bekale wey hold di position for eighteen months.

She be di first woman ever to hold that kain high position for di history of di West African kontri.

Who be Rose Christiane Ossouka Raponda?

Rose Christiane Ossouka Raponda na 56 years old. Dem born her for 1964 for Gabon. She be member of di ruling party Mpongwe people

Raponda get degree for Economics from di Gabonese Institute of Economy and Finance.

Raponda begin her career work as Director General of Economy and Deputy Director General of the Housing Bank of Gabon. For February 2012, dem appoint her as Minister for Budget, Public Accounts and the Public Service where she serve until January 2014. Dem say she leave surplus budget for di ministry.

For 2014, she become di first female mayor for di kontri capital, Libreville. Wen she dey that position, she bin perform very well and leave surplus money for di institution budget.

Dem appoint her as Defence Minister for February 2019 afta one failed coup against di president.

Wetin she go do for dis new role

Her main mission for dis new role na to turn around di economy of di kontri and to continue to dey provide social support to di Gbonese pipo wey dey feel di impact of coronavirus.

She gats find solution to di oil production and price wey dey fall for di kontri and tackle di ongoing coronavirus pandemic. Oil na di major revenue of di kontri.

According to Reuters, her first job go be to form new goment afta di pesin wey dey hold di position before Julien Nkoghe Bekale step down and she go also try calm down di political scene wey don dey tensed for di kontri wen di president Bongo get stroke for 2018 and dem bin plan coup to remove am wen e dey abroad dey receive treatment.