Nigeria Police recruitment 2020: NPF on how many recruits dem wan employ from www.policerecruitment.gov.ng – See wetin go determine your employment if you don submit your form

Nigeria Police recruitment for 2020 recruits start on 14 July and go end afta six weeks, 23, August.

For 2019, di Police inside di West African nation say dem employ 10,000 applicants but e no dey clear how many pipo dem wan recruit dis year.

So BBC Pidgin follow Nigeria Police Force tok to clear di mata as e concern number of recruits dem wan employ.

Frank Mba, di Force PRO on Wednesday tell BBC how many pipo di Nigerian Police dey plan to employ into di force dis year and how dem wan select di candidates.

Wetin e tok?

  • DCP Frank Mba say, at dis stage im no fit tok how many slots dem don put aside for candidates per state but im dey sure say di process of di recruitment go dey transparent, E go dey fair, and dem go distribute di slots per states, equally.
  • “Di Federal Character Commission go dey watch our process of recruitment to make sure say we dey follow di correct guideline”. He add am.
  • To determine di exact number of pipo wey we go employ, we go wait till di application close to know how many pipo don apply, he tok
  • He tok say di application and even till di employment stage dey free-pipo wey go apply no go pay moni.
  • He say for di last recruitment dem employ 10,000 pipo but e no dey clear how many dem go fit take in dis year sake of di coronavirus pandemic wey don affect plenti tins for di kontri.
  • Sake of coronavirus, we must make sure pipo no too plenti for our training schools.He tok.
  • Oga Frank tok say dem go take di recruitment process one step at a time and approach am wit caution sake of di pandemic.