School resumption: FG give greenlight for reopening, lift ban on interstate movement

Federal goment don lift di ban on interstate travel only outside curfew hours with effect from July 1st, 2020.

Di head of di Presidential taskforce on Covid-19 Boss Mustapha make di announcement today for di daily coronavirus update.

Oga Boss say, goment approve di extension of di lockdown ease phase two by anoda four weeks with slight modification.

Dis dey come on top di rise in new cases of coronavirus for di kontri. E don pass 24,000.

Oda tins im tok

  • Safe re-opening of schools to allow students for graduating classes to resume in-person in preparation for examinations
  • Safe reopening of domestic aviation services as soon as practicable

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.