Nigeria coronavirus cases: 25 pipo die with Covid-19 for Lagos in four days

Di Nigeria Centre for Disease control say 25 pipo die with coronavirus for Lagos, south west Nigeria between 12 June to 15 June, 2020.

NCDC announce am as part of dia daily updates on the coronavirus cases for di kontri.

According to di latest report wey NCDC give, Nigeria don record 17,148 confam cases of coronavirus infections.

Di kontri record 490 new confam cases of Covid-19 disease and e don enta 35 out of di 36 states of di federation including Abuja, di federal capital of di kontri.

Dis na di breakdown of di latest figures:

490 new cases of Covid-19 for Nigeria

17,148 new confam cases

5,623 don dey discharged

455 pipo don die

Lagos-142

FCT-60

Bayelsa-54

Rivers-39

Delta-37

Oyo-30

Kaduna-26

Imo-23

Enugu-19

Kwara-17

Gombe-11

Ondo-10

Bauchi-8

Ogun-7

Borno-6

Benue-1