Naira Marley: Executive Jet airline flight mistake Naira Marley real name to be Fashola Babatunde during Abuja concert inside Jabi Lake Mall

Nigeria singer Afeez Fashola AKA Naira Marley don react to one airline claim say dem mistake im name to allow am use dia private jet inside to fly inter-state during lockdown.

Tori be say Executive Jet airline flight mistake Naira Marley real name to be Fashola Babatunde during di ‘Opotoyi’ singe Abuja concert inside Jabi Lake Mall on Saturday, 16 June.

Dis dey follow one press release from Executive Jest Services wey bin dey circulate for social media earlier on Tuesday afta goment suspend di airline on Monday sake of say dem fly Naira Marley go di Abuja for concert.

Nigeria minister for Aviation, Hadi Sirika say di flight wey cari di popular musician from Lagos go Abuja for one concert dem bin approve am for a different purpose.

Oga Sirika say based on dis, di flight company dey suspended until further notice.

For inside di statement wey di executive chairman of di airline, Dr. Sam Iwuajoku use apologise for breaking di coronavirus lockdown rules, e tok say;

“For di manifest wey my staff send to me before di departure, I see FASHOLA BABATUNDE and I tink say na di Honorable Minister of Works dey go Abuja with im men….” He tok say im no sabi say na di artist and im crew but di way im take describe dem for di statement don cause some kain controversy.

Naira Marley enta twitter on later on Tuesday to reply di statement.

“Dem ask for our names on di jet, I tell dem say my name na Azeez Adeshina Fashola and my little brother name na Moshood Babatunde Fashola.” Di Nigerian singer tok

Saturday night catch fire for Jabi Lake Mall as pipo ignore di federal goment order on public gathering to prevent di spread of coronavirus, to go jollificate, dance and groove for di drive-in concert wey di Nigeria Afrobeat musician perform.

Even though goment neva reopen airports and interstate lockdown wey dem put ova two months to control di spread of coronavirus, Naira Marley somehow still find im sef for Abuja.

Di organisers say di show suppose be drive-in concert, meaning say, pipo must to come inside car, and dem must to sidon inside dia car to watch as im dey perform for stage.

But, video wey go viral for social media show as crowd gada dey dance as im dey stage dey sing and dem no observe social distancing.

As video from di concert go viral for social media, na different kind of reactions from Nigerians for social media follow am.

For April 2020, Naira Marley togeda wit actress Funke Akindele and her husband bin enter soup afta dem take part in birthday party to celebrate di actress husband, Rasheed Bello aka JJC Skills.