Bayo Osinowo: Senator Adebayo Osinowo AKA Pepperito die at di age of 64 – dis na im brief biography

Senator Adebayo Osinowo wey dey represent Lagos East senatorial district don die.

Na Gboyega Akosile di chief press secretary to di Lagos State Govnor confam di tori to BBC.

Before im pass away, im be di Chairman of di Senate Committee on Industries.

Speaker of di House of Representatives Femi Gbajabiamila don describe as shocking and saddening di passing of Sen. Bayo Osinowo.

Senator Osinowo, die on Monday afternoon at di age of 64.

Wetin you gatz know about ”Pepperito”

Im don tanda for Nigerian Senate as lawmaker for four times since 2003.

Di late Bayo Osinowo AKA Pepperito bin serve as chairman, Lagos State House of Assembly Committee on Lands and Housing for 11 years.

Im be native of Ijebu-Ode, Ogun State. Na him defeat Gbenga Ashafa for di last senate election.

Senator Osinowo bin get Diploma in Building Technology from Instituto per Geometri, Rome, Italy. E also study Italian Language.

Im also get Masters Degree in Mass Communication from the Urbaniana University in Rome, Italy.

Until im death, Senator Adebayo Osinowo bin dey married and get children.