Bobrisky allege bribery audio, alarm wey Very dark blackman blow dey legal?

Bobrisky

BBC
Bobrisky, wey get more dan five million followers on Instagram, appear for court for April

Di allege bribery audio recording of popular Nigeria cross dresser Bobrisky, dey make many pipo tok for di kontri.

Di mata trend for social media on Wednesday afta one social media influencer, Very Dark Man release audio recording of di cross dresser wey allege say im pay bribe of 15 million naira ($9000) for di authorities to drop charges against am and secure private apartment instead of prison.

Bobrisky wey get more dan five millions followers for Instagram don deny say na im voice dey di audio.

Very Dark Man wey im real name na Martins Otse no be di first pesin to release audio for social media.

But to record pesin without dia consent dey legal for Nigeria?. BBC Pidgin speak to Barrister Jiti Ogunye to torchlight di mata.

‘’Nobody dey permitted to hack your phone or to eavesdrop or waya tap your conversation’’. Barrister Jiti Ogunye tok.

Section 37 of di constitution, di section under chapter four guarantee fundamental human right for Nigeria, e tok about guaranteeing di privacy, integrity and inviolability of pipo homes, correspondences, telephone conversation and private communications.

‘’Aside di fundamental human right law we also get di cyber crime act wey dey deal wit di issue of digital age and crimes wey fit dey committed through dat process. Dat law also cover sometin like dis. Barrister Ogunye add put.

‘’Na why law enforcement institution bifor dem fit wiretap or eavesdrop dem go rely on di enabling laws wey permit dem to do so, only on account of law enforcement and criminal justice investigation generally’’. Di Lawyer explain.

Barrister Ogunye analyse Bobrisky case and break down di issues;

According to report, wey claim say Bobrisky borrow money from one man, in oda for am to get money from dat pesin im begin make all sorts of claims, Barrister Ogunye explain.

E tok how im need money for im hour of need to bribe prison officials, bribe from di top for Abuja to make sure say im no go prison.

VDM get di audio of di recording and make Instagram and Facebook broadcast and issue threat to Bobrisky to say im dey owe pesin, make im go pay di money.

If im no pay di money im go release di audio.

Bobrisky no pay di money so im release di audio and start to make wild comment about di cross dresser sexuality and many more.

Bobrisky later pay di money by den di audio don go viral.

Wetin be di Issues for dis mata, according Jiti Ogunye

Dis mata get serious legal implications and those wey dey directly involved go feel di impact of dia actions, di spectators no go bear any responsibility wen tins like dis happun.

Pipo wey dey call VDM whistle blower, di kwesion wey I wan ask, to owe pesin na offence?

VDM na debt recovery agency, so if pesin dey owe pesin di law say make you carry di pesin go court, sue di pesin to pay you. Who make am authority to use telephone conversation to blackmail pipo to pay money or settle debt.

Di law require you to hire lawyer to recover your debt or you make di pesin to pay penalty or damages.

Di second issue, so if someone get conversation wit a contact a friend or associate to beg money and lie to convince di pesin to give am money by name dropping just to collect money from pipo, I feel say na wetin Bobrisky do, u know weda na wetin im do be dat, u investigate am? Bifor you go social media to go scandalize am.

Now di content of wetin im tok say im give money to Efcc so dem go drop di charge, na true? If na true den na criminal offence but assuming say no be true and Bobrisky just tok anyhow just to collect money from di oda pesin.

Now di oda pesin don feel say wetin Bobrisky tok carry weight so im fit use dat tin to blackmail am, so im mean say, dis pesin don enable blackmail. Sake of how e use im platform to call evri body out wen you no get di proof.

If indeed dem send Bobrisky to prison for abuse of di naira, na for dsi kontri wia di same period of time anoda celebrity, Cubana chief priest go dat same court and dem give am plea bargain plus right to settle, im no go prison. Dia must be equality of all bifor di law.

So you go say Bobrisky no dey entitled to also wipe up di taint of dat conviction?

Govnor Sanwo Olu pardon Funke Akindele for Lagos hia afta she throw party during Covid.

Na Bobrisky legal right to look for pardon but if na true say as im look for Pardon and contact Ogbonge lawyer Femi Falana son afta allegedly im law lawyer bin mess im case up.

If Falana take di case im no dey entiltled to charge am? so if im charge fees e mean say im tamper wit justice?

Barrister Ogunye advise Nigerians to dey careful di way dem dey lift pipo voices and videos for social media.

Na offence to invade pipo telephone conversation dia letters, video and post am for social media under dubious name to call am corruption. You no be police.

Bobrisky case as e happun

4 April 2024: EFCC confam say Bobrisky dey dia custody and e go appear bifor di court on 5 April, wit six-count charges against am by di commission.

April 2024: Court bin sentence Bobrisky to six months in prison for naira abuse afta im plead guilty to di crime.

5 August 2024: Bobrisky comot for prison afta im six months jail term wey begin count from 24 March, 2024 di day wey EFCC first put am for detention.

23 September 2024: Verydarkblackman bin share one viral recording, wey im allegedly claim say e belong to Bobrisky.

24 September 2024: EFCC begin investigate di accusations.

25 September 2024: Ministry of Interior also say dem go torchlight di mata

26 September 2024: House of reps and NCOS announce say dem go probe di bribery allegation

26 September 2024: NCOS suspend two officials for Bobrisky allege bribery case

Source