Mama of nine-month-old pikin dey part of pipo cholera kill for Ebonyi – how you fit avoid di disease

A woman in the lab

Getty Images

Mama of nine-month-old pikin dey part of di pipo wey cholera kill for Ndibokote village of Ezza Inyimagu for di Izzi Local Goment Area of Ebonyi State, south-eastern Nigeria.

Na ten pipo die sake of di outbreak, di Ebonyi State Health Commissioner Moses Ekuma confam dis inside one statement by di ministry tok-tok pesin, Lucy Anyim.

Apart from di deceased, about 20 pipo wey di outbreak affect dey respond to treatment.

Di ministry say dem don make efforts to put di disease under control from spreading around di community.

According to Ekuma, di state Govnor Francis Nwifuru don approve di procurement of medical commodities to combat di spread of di outbreak.

Ekuma say three treatment centres including di Iziogo Health Centre, Sudan Mission Onuenyim, and Ndibokote village don dey established for di area.

Sabi pipo tok say na open defecation and poor hygiene dey cause di outbreak of di disease, as most communities get drinking water from streams.

Dem advise pipo to take precautionary measures to prevent di spread of di disease.

Cholera symptoms

According to di National Health Service (NHS) for UK, below na di symptoms of cholera:

  • Watery poo wey go make you go toilet well-well
  • Feeling sick or you dey sick
  • Belle pain
  • dehydration

How to avoid cholera

Dis na tins you fit do to help you to avoid to fall sick if you dey travel to areas wia cholera dey:

Wash your hands wit soap and water regularly, especially afta you go toilet and before you prepare food or eat

Only drink bottled water or tap water wey dem boil

Brush your teeth wit bottled or boiled water

Tins you no suppose do

  • No eat uncooked fruit and vegetables (including salads) wey you no wash wit bottled or boiled water and prepare yourself
  • No eat seafood
  • No use ice for your drinks

Vaccination for cholera

Vaccine dey for cholera, but most pipo no need am.

Dem dey give di vaccine like drink. For adults, 2 doses (dem dey give dem 1 to 6 weeks apart)

E fit provide protection for up to 2 years.

Treatment for cholera

Di main treatment for cholera na to drink plenty of fluids, including rehydration solution.

Di rehydration solution na powder wey you go mix wit water to replace salts, sugars and minerals wey your bodi don lose through diarrhoea. Usually e dey available from pharmacies.

If you dey veri sick, you go need take treatment for hospital wia dem go teat you wit

  • fluids through a vein
  • antibiotics

Source