Cabinet reshuffle – Why Nigeria President wan change Ministers

Nigeria President Bola Tinubu don tok say im wan change or switch di pipo wey dey im cabinet.

Di current cabinet members na di Ministers wey dey head different goment ministries.

And for dis current administration, dem dey 42 in number and na for August 2023 dem swear enta office.

Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga confam di cabinet change new to tori pipo for di Presidential Villa, Abuja.

“I no get any timeline. Di President don tok im mind to change im cabinet and im go do am. I no know weda im wan do am bifor October 1, but im go surely do am.”

Im add say President Tinubu administration get plenti records of significant achievements as dem dey try to change di economy to beta for evribodi and members of di public sabi dis fact.

Onanuga say Presido Tinubu wan shake-up im cabinet based on “empirical evidence”.

Im explain say during one retreat wey dem bin organise for di ministers afta dia swearing-in for August 2023, Tinubu make am clear say dem go dey chook eye on how dem dey perform from time to time.

And na from dia di President go decide which minister go comot and which one go stay.

Why presidents dey reshuffle dia cabinets

Cabinet ‘shake-up’ or reshuffle na common tin wey dey happun around di world.

E dey aslo happun for both corporate, public and private environments.

Recently, Kenya goment bring out list of additional cabinet secretary nominees as President William Ruto announce for nationwide broadcast.

Di Kenyan president bin announce di Nominees for di proposed cabinet afta e dismiss all im secretaries.

Im bin add say, di cabinet change “dey important to constitute more inclusive goment wey go unlock di potential of citizens from all sectors to drive national transformation.”

Dis wan show say evri administration get dia reasons to change cabinet, but most of di reasons for for improved administration, one sabi tok.

E dey no different from wetin President Bola Tinubu dey plan to do, so dat di Minister wey dey work with am go work well, while di ones wey no dey work well go comot.

For Nigeria, cabinet reshuffle fit happun anytime, e no get any particular timeline.

Di goment of di day fit decide to change, swap or remove any cabinet member based on some factors like, under performance, high performance, quota system, skill and oda political factors.

‘Cabinet reshuffle mean say goment dey listen to di pipo’

Political administrator and analyst, Eugene Abels don chook mouth for dis cabinet reshuffle mata say for Nigeria, bifor you chook leg to become president, you suppose don know di areas you wan work on and get plan on how to do di work.

“Di pipo beliv say you get beta plan wey you don already tell dem thru your manifestos and campaigns and debate,” di Executive Director of Extra Step Initiative tok.

Im give example wia some candidates no dey agree to go debate, give manifestos -instead na pipo dey tok on dia behalf and for di national level, parliament go tell dem to “take a bow and go” wey no be di real essence of di screening process.

Wen you enta office you raise your best team, put dem in front of di representatives of di pipo (parliament) to screen dem, if dem pass dem go approve but if di pipo fail dem no go approve”

Oga Abels say dis na wetin dey happun across di world but for Nigeria many times dem no dey follow di right process and e go later cause kasala for governance.

“Di essence na for all nominees wey wan occupy any position of public office by di new elected president, make dem drill dem well-well and make sure say dem dey competent to run di office bifor dem clear dem and swear dem into office.

How dem dey measure performance of cabinet members?

Afta swearing-in, president go give dem clear targets and e go also reflect di six geo-political zones based on di problems wey di president don identify and im go solve di problems.

Na former NPA oga Hadiza Bala Usman wey now be special adviser on policy coordination to di President ge di work to know how each minister dey perform.

Oga Abels explain say wen dis pipo don enta office di president go give imsef and dem “a period of feedback” wia dem go look dia performance level. Im say di perfomance level measurement fit come from di public, your own team or anywia as di case may be.

“Di measurement dey come in different ways like project proposals and defence, di memos wey dem write , wetin be di socio-economic impact of di projects wey dem dey bring to di president.

“If we chook eye inside dis oga Tinubu administration for example, wetin don happun in di last one year be say, dem enta with plenti problems so im bin need im best hands.”

“Just like football match if any player no dey do well coach go change am. Di main importance of cabinet reshuffle mean say di goment dey listen to di pipo” Oga Abels conclude.

For July, 2022 former President Muhammadu Buhari do small cabinet reshuffle afta im bin swear in seven new ministers.

For October, 2014 anoda former President Goodluck Jonathan do small cabinet reshuffling afta seven of im ministers bin resign dia positions to pursue dia political ambitions.

Fo now e neva dey clear which minister go comot and di one wey go stay.

Source