Why Nigeria goment increase NYSC ‘alawee’ to 77,000 naira

Nigeria goment don approve 77,000 naira ($47) monthly allowance for National Youth Service Corps (NYSC) members.

Di monthly allowance of Corps members bifor na 33,000 naira ($20).

Youth corps members go begin receive di new payment wey goment back date to July 2024, according to statement from di NYSC tok-tok pesin, Caroline Embu.

She say dis increment dey in line wit di implementation of di National Minimum Wage (Amendment) Act 2024.

NYSC tok say “we receive di tori from di letter wey di National Salaries, Incomes and Wages Commission, dated 25th September 2024 and signed by di Chairman, Ekpo Nta.”

Lawmakers in July pass National Minimum Wage Act 2024, all employers of labor for Nigeria go begin pay dia low ranking staff atleast 70,000 naira ($43) monthly as approved by di president.

Many Nigerian workers don dey cry say di harsh economic situation no let dia take-home of 30,000 naira ($18) dey in tune wit di economic reality and substantially of dia lifestyle.

For di past five years, Nigeria goment don set minimum wage as 30,000 naira ($18) per month, wey bin dey $80 in 2019, wey devaluation of naira cause.

President Bola Tinubu and organised labour union agree on 70,000 naira as di new minimum wage for Nigeria in di same July.

Di new minimum wage don take effect immediately as federal lawmakers don pass di Minimum Wage Act 2024 into law to implement di approved 70,000 naira minimum wage.

In public sector, goment go pay civil servant based on dia job position, wey go reflect on di approved wages for di staff.

Nigeria inflation dey around 33% – dis don affect di prices of food items for market and many low income Nigerians no fit feed well.

Meanwhile, Embu for her statement explain say di Director General, NYSC Brigadier General YD Ahmed, bin go for one advocacy visit to di Chairman, and na for dat visit im ask for beta welfare package for Corps members.

Di NYSC oga tank di Federal goment for as dem wan implement dis welfare package sharp sharp.

Im also beliv say di increment go reduce di suffering of Corps Members, and e go also boost dia morale and ginger dem to do even more, as dem dey serve di nation.

Nigeria National Youth Service Corps (NYSC) na one-year mandatory national service for pipo wey graduate from higher institution.

Na in di 1970s dem introduce am wit di hope say e go promote nity among di different ethnic communities for Nigeria.

Typically, dem dey post NYSC member go schools or hospitals wey far from dia house to oda parts of di kontri.

Source