Who be di members of di UN Security Council and wetin e go mean for Africa to get a permanent seat?

Nigeria President Bola Tinubu dey ask leaders for di world to tighten di bond wey dey among kontris wey be dia members.

Presido, Bola Tinubu also add say make Nigeria and oda African kontris get permanent seats for di United Nations Security Council.

Na wetin Vice President of Nigeria, Kashim Shettima tok wen im stand on behalf of Tinubu to address world leaders during di General Debate of di ongoing 79th Session of di United Nations General Assembly for di UN headquarters for New York, United States.

Im add say make all of dem collabo so dat dem fit take action against hunger, terrorism, climate change, and oda tins wey dey make life hard for developing kontris.

Oda tins im ask for na renewed financial architecture, debt forgiveness for developing kontris.

Im explain say di way wey dem dey pursue individual national priorities dey make di resolutions of global challenges look like say e no important.

One of di key tins Presido, Bola Tinubu point out for di UN General Assembly na make Nigeria and oda African kontris get permanent seats for di United Nations Security Council.

Wetin be di UN Security council and dia work?

According to di United Nations website, di Security Council dey in charge of Peace and Security for di world.

Di Security Council takes dey take di lead to determine if any threat dey exist, or if anytin dey happun wey go threaten peace for di world or cause kasala.

Wen dem don identify anytin wey go cause kasala, dem go call di kontris to settle di problem by peaceful means.

Dem dey also recommend methods of adjustment or terms of settlement. For some cases, di Security Council fit try to impose sanctions.

Dem fit even authorise di use of force just to maintain or restore international peace and security.

Dia main work na to maintain international peace and security. Dia latest assignment na to hold meeting on how to maintain peace for Ukraine.

Which kontris dey di Security Council?

Di United Nations Security Council get 15 members, dem divide dis members into two groups.

Di groups na Permanent members and Non-permanent members and evri member get only one vote.

Di permanent members na five kontris wey be China, France, Russia, United Kingdom and United States.

Di Non-permanent members na ten, dem be Algeria, Ecuador, Guyana, Japan, Malta, Mozambique, Republic of Korea, Sierra Leone, Switzerland.

Dem dey select di ten non-permanent members by election for a two-year term by di General Assembly.

Most of dis kontris, dia two-year term go end between 2024 and 2025.

Meanwhile some kontris dey wey be Non-Council Member States and dem pass 50 kontris wey neva be members of di Security Council.

Any kontri wey be member of di United Nations, but no dey for di Security Council fit participate for any tok-tok, but dem no go fit vote for discussions wen di Council dey consider anytin wey fit affect di interest of di kontri.

Dem go invite both members and non-members of di United Nations, if dem be parties to a dispute wey di Council dey consider but dem no go fit vote.

Under di Charter of di United Nations, all di kontris wey be members must obey any decision wey di Council make.

Any African kontri dey di security council?

For now, no African kontri be Permanent member na why President Bola Tinubu dey ask di General Assemby to make Nigeria or oda African kontris permanent member.

And na only Algeria, Sierra -Leone and Mozambique bi di African kontris wey be non-permanent members.

If Nigeria or any African kontri become permanent members, e mean say Nigeria go fit chook mouth wen di security council do tok-tok for peace for any part of di world.

Dia seat go dey permanent, dem no go dey elect oda kontris for di continent to replace dem afta evri two-year term.

For Africa, di African Union dey use an internal system to rotate who go be member by regions and sub-regions.

One odd-year seat dey change between Eastern Africa and Southern Africa (only Eastern Africa dey get am before dem create di Southern Africa sub region for 1979.

One even-year seat dey allocated to West Africa and anoda even-year seat dey change between North Africa (di Arab nation seat) and Central Africa (with one exception for di beginning for 1966)

Former non permanent African members of di security council plenti well-well, some of dem include Ghana, Cote d’Ivoire, Morocco, Egypt, Tunisia, Algeria

Nigeria represent Africa last as a non-permanent member of di Security Council for 2015.

Di first time Nigeria dey dat position na 1966 and from dat time, di West African kontri don hold di position ten times.

Ghana first hold di position for 1962, di last time dey hold am na 2023, dem bin don hold di position 8 times.

Source