Wetin we know about di migrants wey dem find dia deadibodi off Senegal coast

Migrants for inside wooden boats

AFP

Military authorities say dem find about 30 deadi-body wey don decompose for one boat off di coast of Senegal.

According to one military statement, dem inform di navy about one vessel wey bin dey float about 70km (45 miles) from di capital Dakar. Dem bring di wooden canoe, or pirogue, to port on Monday morning.

For di statement, dem say “recovery, identification and transfer operations dey very delicate sake of di advanced state of decomposition of di body dem’’.

Tori be say di number of migrants wey dey take off from Senegal go Spain Canary Islands don increase – for journey wey dey more dan 1,500km (950 miles) across di Atlantic Ocean.

Sake of how dia body decompose, e look like di migrants bin probably float for Atlantic Ocean for many days bifor fishermen find dem.

Investigations dey go on to determine wen and wia di boat bin dey come from, and how many pipo bin dey inside, di army tok.

For August, one local fisherman find about 14 decomposing bodies, wey many believe say be Senegalese migrants, for river for Dominican Republic.

Senegal goment bin announce 10-year plan for August to tackle illegal migration sake of di increase of migrant-related deaths.

Authorities say dem don stop hundreds of migrants inside boats for di kontri coast in recent weeks.

Even wit all di frequent tragedies, unemployment, conflict and poverty na im dey push young men to risk di route from West Africa to Spain Canary Islands.

Some Senegalese fishermen say dem no fit survive by fishing again because of di presence of foreign trawlers wey dey operate for di coast, so now, dem dey turn to either migration, or offer dia boats to pipo smugglers to use.

Young West African migrants now don plenty wey dey use di Canary Islands route to reach Europe because e involve just one single, although dangerous, journey rather dan crossing both di Sahara Desert and di Mediterranean Sea.

Frontex, di European border agency, report say for 2023, di Atlantic route see a 161% increase compared to di previous year.

Di UN say about 40,000 migrants make am to di Canary Islands last year.

Nearly 1,000 pipo die or disappear on dia way. Although di real number dey likely to dey higher.

Source