How American citizens for Nigeria and diaspora fit vote for di US November elections

White House stylised wit stars and stripes

BBC

United States of America don issue voting guidance for dia citizens wey dey live for Nigeria ahead of di 5 November election.

Di United States Mission in Nigeria for one statement on dia X account, tok say di guidelines also apply to dia citizens wey dey for diaspora.

Di guideline outline di three steps wey US citizens wey dey outside di kontri must follow if dem wan be part of di electoral process and if dia votes go dey counted.

Wetin be di guidelines

Request your ballot: US citizens for diaspora must first request dia ballots for di website of di Federal Voting Assistance Program. Details of how to request a ballot plus oda resources for voters in diaspora dey di site.

Receive and complete di ballot: For most states, you fit confam your registration and ballot delivery online. Once di voter don receive di ballot e fit fill am according to di provided instructions.

Return your ballot: You fit drop your completed ballot for inside postage-paid envelope for di consular section of di U.S. Embassy for Abuja or di Consulate General for Lagos, or you fit mail am yourself.

Di embassy say di deadline for submitting of ballot na 3 October, 2024. Dem say dis na to ensure say e arrive by election day.

Afta dis date we go kontinu to collect and mail ballots, but we no fit guarantee say dem go land by election day, di statement tok.

Who fit vote for di US presidential election?

Most US citizens wey dey di age of18 or ova dey eligible to vote for di presidential election.

All states apart from North Dakota require pipo to register before dem fit vote.

Every oda state get dia own voter registration process and deadline.

US citizens wey dey live for abroad fitregister to vote and request an absentee postal ballot by completing di Federal Post Card Application (FCPA).

About di US elections

Americans go enta polls on 5 November to elect di next US president.

Na one election wey pipo around di world go pay close attention to.

Dem go also vote for members of Congress, wey dey play ogbonge role in passing laws wey fit get profound effect on American life.

Di two main parties don nominate presidential candidate for di election – di Democrats nominate Vice President Kamala Harris, afta President Joe Biden comot di race and no oda Democrat stand against her.

For di Republican Party, dem nominate former president Donald Trump.

Di winner go serve a term of four years for di White House, starting from January 2025.

Source