Inec declare Monday Okpebholo winner of Edo governorship election

Monday Okpebolo

BBC

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare Monday Okpebholo winner of di Edo state 2024 governorship election.

Okpebholo beat im closest rival Asue Ighodalo of di People’s Democratic Party by scoring 291,667 votes.

PDP candidate Asue Ighodalo score 247,274 votes and Labour Party candidate Olumide Akpata wey finish third score 22,763 votes.

Na di State returning officer Prof Faruk Adamu Kuta, Vice-Chancellor, Federal University of Technology, Minna declare Okpebholo winner of di election.

Early analysis of results upload for Inec IReV portal bin don show say di Peoples Democratic Party, Asue Ighodalo, and im All Progressives Congress counterpart, Senator Monday Okpebholo, dey run for one tight race.

But Okpebholo edge out Ighodalo. Labour Party candidate Olumide Akpata carry third.

For im campaign promises, Okpebholo bin tok about issue of insecurity, economy, infrastructural development, educational development as some of di tins wey im go focus if im win di election.

Okpebholo explain im plans to BBC Pidgin for one exclusive interview say im go use technology fight insecurity.

Insecurity be one area wey dey worry for di state, but di govnor-elect bin say e go tackle am both manually and wit technology if e win.

E bin also tok about Marginalisation of Edo pipo, “I wan become govnor of Edo state becos Edo never dey marginalised as im dey like dis bifor.

Based on wetin Okpebholo bin tok for di interview, Im first task and priority if im win and assume office, na say im go declare “state of emergency on our roads, insecurity for Edo state and on di education sector”.

Okpebholo bin cast im ballot for Unit 03, Ward 1, Uwessan for Esan Central Local govment Area of Edo state wia e come from.

E bin poll 102 votes, while both PDP Ighodalo and di Labour Party candidate, Akpata, gbab one vote each.

Edo election final result

BBC

Monday Okpebholo biography

Dem born Monday Okpebholo for August 1970 Udomi-Uwessan community of Irrua Esan Central Local Govment Area.

E be businessman and politician wey dey serve as di senator wey represent Edo Central senatorial district since 2023.

Okpebholo bin attend Udomi Community Primary School and Ujabhole Community Secondary School, both for Uwesan Irrua, Esan Central local govment.

E bin complete im secondary education and gbab im senior school certificate for Jos, Plateau State.

E gba degree for Business Administration from di University of Abuja and hold Masters’ degree for Policy and Leadership Studies from di same institution.

Monday Okpebholo bin contest and win di Senate Seat for Edo Central senatorial district, under di All Progressives Congress (APC) for di 25 February 2023 election.

E dey Inaugurated for di 10th National Assembly of Nigeria as Senator for June 2023.

For February 2024, e bin win di Edo State APC gubernatorial primary election.

Early 2024, one magistrate court bin summon Okpebholo for allegations say e falsify date of birth for im certificate, di matter still dey court.

Okpebholo day married and get two children.

Source