John stones late goal save Manchester City from home defeat against Arsenal

Manchester City vs Arsenal

Getty Images

Manchester City wait until di last minute of added time before dem score di equalizer to draw 2-2 wit Arsenal.

John Stone score di late goal for Manchester City wey bin dey under serious pressure to score Sunday dem fit protect dia unbeaten run.

Arsenal wey give defending Champions Manchester tough time for di match bin come from behind to score two goals.

Di match wey get plenti action see Manchester City score for di 9th minute thru Erling Haaland.

Arsenal equalise thru Riccardo Calafiori for di 22nd minute.

Arsenal score dia second goal for added time of first.

Plenti drama happun for di match wey see plenti yellow card and one red card.

Match highlights

Arsenal celebrate goal against Manchester City

Getty Images
Arsenal celebrate goal wey Riccardo Calafiori score

Second Half

Full Time Manchester City 2-2 Arsenal

90+8 Referee blow whistle match don end

Manchester City 2-2 Arsenal

90+7 GOAL!!! Manchester City score!!!! John Stones bury di ball inside net!

90+7 Last attack attempt for Manchester City wey dey under pressur!

90+6 Phil Foden of Manchester City fire shot from di edge of di box Arsenal goalkeeper save am wit confidenc.

90+2 Substitution fir Arsenal Myles Lewis-Skelly don enta to replace Jurrien Timber wey injure.

90+1 Bernardo Silva of Manchester City collect yellow card.

90+1 Jurrien Timber dey down wit injury and referee stop di match so dat im fit get treatment.

90+1 Referee add 7 minutes

87’ Substitution for Arsenal, Gabriel Martinelli don replace Gabriel Jesus.

87’ Big chance for Manchester City but Josko Gvardiol waste di opportunit. E fire shot from mid range towards di bottom left corner, David Raya save am again!

85’ Manchester City dey mount pressure on Arsenal defence but David Rays na dia nemesis today.

84’ Manuel Akanji of Manchester City send beta cross into di area but David Raya Arsenal goalkeeper block di ball.

83’ Declan Rice of Arsenal collect yellow card as e try to delay di match.

82’ Mateo Kovacic of Manchester City make one strong challenge Referee blow whistle for foul and Arsenal get free kick.

80’ Manchester City dey under serious pressure! Mateo Kovacic shot no go well as im effort fly over di bar!

78’ Substitutio for Manchester City as Guardiola bring in Jack Grealish to replace Savinho.

78’ Sunstitution for Manchester City, Kyle Walker don comot and John Stones don enta.

78’ Phil Foden of Manchester City fire shot too but I’m effort go over do bar. Manchester City dey under pressure to score!.

77’ Erling Haaland of Manchester City fire beta shot but defender block am.

Manchester City vs Arsenal

Getty Images

76’ David Raya Arsenal goalkeeper save beat long range effort from Ruben Dias of Manchester City near di middle of goal post.

74’ Substitution, Riccardo Calafiori of Arsenal no go fit kontinu wit di match sake of injury. Jakub Kiwior don replace am.

72’ Ruben Dias of Manchester City collect one beta pass, im strike di ball from outside but dem block im shot.

70’ Freekick for Arsenal afta Ruben Dias of Manchester City challenge im opponent badl, Referee blow whistle for foul.

69’ Substitution for Manchester City, Phil Foden don enta to replace Jeremy Doku.

66’ David Raya of Arsenal wey bin dey take medical attention don dey okay now.

65’ Myles Lewis-Skelly of Arsenal don collect yellow card for yeye behaviour.

62’ Josko Gvardiol of Manchester City dey beta position na di first pesin to get do bal wey bounce back, im fire a low shot towards di middle of goal but David Raya save so ball.

61’ Kyle Walker of Manchester City control one pass from di edge of di box e fire shot towards goal but defender block and clear di ball.

59’ Erling Haaland of Manchester City escape di pesin wey dey mark am to connect wit one beta cross , im nod am very low towards di right side of goal, but di goalkeeper save am!

59’ Manchester City play short corner kick as dem pass di ball to a nearby teammate.

57’ Kyle Walker of Manchester City fire one beta shot di ball go towards di right post but David Raya save am.

57’ Manuel Akanji of Manchester City fire one shot at goal from beta position outside di penalty area but defender block am.

Manchester City vs Arsenal

Getty Images

56’ Corner kick for Manchester City, Jeremy Dokubplay am but na short corner kick e play.

55’ Savinho of Manchester City collect one pass from di edge of di box e fire beta shot but defender block am.

53’ Bernardo Silva find Ruben Dias of Manchester City afta a very hard work, but e shoot im attempt from di edge of di box out of play.

52’ Bernardo Silva of Manchester City send in one cross from free kick from di corner of di box but di ball go out of pla.

50’ Mateo Kovacic of Manchester City send beta pass into di box near Savinho, im dribble im try to dribble opponent but im no succeed. Dem clear di ball.

48’ Erling Haaland of Manchester City raise im head to nod one cross towards di left corner but di ball no go wia e wan place am David Rays save am.

47’ Kai Havertz of Arsenal don commit foul and referee blow whistl.

47’ Kyle Walker of Manchester City pass ball from a very tight place into di box for Bernardo Silva but David Raya stop am.

46’ Substitution for Arsenal, Ben White enta to replace Bukayo Saka

46’ Referee don low whistle and second half don start.

First Half

Manchester City celebrate goal against Arsenal

Getty Images
Manchester City celebrate dia first goal against Arsenal for di match

45+10′ First half don end

45+8′ Leandro Trossard of Arsenal collect anoda yellow card and Referee show am RED CARD !

45+7′ Yellow card for Thomas Partey of Arsenal

45+2′ Referee say NO FOUL!

45+2′ Referee go check VAR to review di goal to check if foul happun.

45+1 Ruben Dias of Manchester City collect yellow card.

45+1 Manchester City 1-2 Arsenal

45+1 GOAL!!! Arsenal score dia second goal as Gabriel fire di ball inside di net.

45′ Referee add 6 minutes.

44′ David Raya block one long pass from Savinho of Manchester City.

43′ Arsenal dey offside.

42′ Gabrielle Martinelli of Arsenal play one pass enta Leandro Trosard leg, im effor go over di bar!.

38′ Bukayo Saka of Arsenal play di corner kick but notin come out.

37′ Bukayo Saka of Arsenal break free but Manchester City player clear di ball. Arsenal ger corner kick.

36′ Corner kick for Manchester City, Savinho play am but e land for di head of dia opponent.

34′ Leandro Trossard of Arsenal collect yellow card afta a very bad tackle on im opponent.

30′ Kyle Walker of Manchester City play one long range ball afta e collect pass, e direct di ball toawards di left post, goalkeeper save am.

28′ Kai Havertz of Arsenal bring down im opponent , referee blow whistle for foul. 24′ Jeremy Doku of Manchester City get half chance to score but e pass di ball into di box.

22′ Ederson of Manchester City chop yellow card sake of di way e tok to referee.

Man City Vs Arsenal

Getty Images

22′ Manchester City 1-1 Arsenal

22′ GOAL for Arsenal !!!! Riccardo Calafiori score from Gabriel Martinelli pass.

21′ Substitution for Manchester City, Mateo Kovacic don replace Rodri sake of di injury.16′ Rodri of Manchester City dey ground wit injury, we neva know if im go fit kontinu wit di match.

15’Beta shot wey IIkay Gundogan of Manchester City playas freekick shake di right post.

12’Referee blow foul aftaafta Gabriel of Arsenal gve im opponet bad tackle.

12′ Erling Haaland make one bad challenge and referee blow whistle for foul.11′ Bukayo Saka of Arsenal waste good chance as dem block di ball wey im pass into di box.

9′ GOAL! Haaland don score as Mancity take di lead.

3mins: Rodri dey for ground afta slight foul by Havertz

Man City 0-0 Arsenal

1min: KICK OFF

Source