Why Israel and Hezbollah dey fight? – Timeline of di latest palava between di two parties

Women carry placards dey protest

Getty Images

Israeli military say dem dey conduct “extensive” air strikes on Hezbollah targets for Lebanon as cross-border attacks between di two sides continue to increase.

Dem advise Lebanese civilians to move away from areas wey di Iran-backed group dey use for military purposes, na so one IDF tok tok pesin tok.

One pesin don die on Monday morning sake of di Israeli air strikes wey happen north of di Bekaa Valley, according to Lebanon health ministry.

Dis dey come after a weekend of cross-border attacks wey see how Hezbollah rockets hit deep inside Israel, reaching targets for di city of Haifa.

Hezbollah deputy leader Ron tok say now, dem dey for an open-ended battle of reckoning with Israel.

Air strikes as seen from Tyre

Reuters
AoAir strike don dey hit across di South of Lebanon since Monday morning – As dem see am from Tyre

Why Israel and Hezbollah dey fight?

Di wahala wey dey happen between Israel and Hezbollah dey connected to di war in Gaza – but e get oda reasons too.

Di catalyst for wetin dey happen now na one rocket attack by di Lebanon-based Hezbollah in and around northern Israel one day after di 7 October Hamas attack on Israel. Israel retaliate and fighting between di two sides don dey shele ever since.

Hezbollah say dem bin dey act out of solidarity with di Palestinians for Gaza, wia a war don dey on between dia padi-padi Hamas and Israel since di 7 October attack.

Cross-border attacks, such as di ones we don dey see since dis past week, for be a strategy by di Hezbollah to put additional pressure on Israel and divert resources away from di war in Gaza.

But gbege between Israel and Hezbollah don dey long before di conflict in Gaza and na part of wider regional dynamics.

Hezbollah align with Iran – wey be Israel arch enemy – wey dey fund, train and equip dia armed wing, di most powerful military force in Lebanon. E present itself as a resistance movement to Israel, though, like Iran, e dey also call for Israel elimination.

Di two sides don fight and attack one anoda since Hezbollah first start in di early 1980s, including in a 34-day war for 2006.

Since den, dem don dey get small-small fight-fight between demsefs around di Israel-Lebanon border, wey break out into fighting in October wey don become more sustained and intensive in recent weeks.

Makary, Lebanon Information Minister

Getty Images
Makary say di methods of sending messages through phones no dey strange for Israel

Phone messages warn citizens for southern Lebanon to avoid Hezbollah targets

Pipo for southern Lebanon begin receive text and voice messages since morning wey warn dem to stay away from “residential buildings wey Hezbollah dey use for hiding weapons”.

For one video wey dey circulate on social media (wey BBC don verify through pipo wey dey live for di south of Lebanon), e show a villager wey receive voice message, wey say di Israeli operation dey continue and e don enter a “new phase”.

Di voice memo continue say: “If you dey for village wey Hezbollah dey use, leave am immediately for your own safety.”

Dis phone messages dey come as similar warnings dey posted on social media – in both English and Arabic – by tok tok pipo for di Israeli military.

Those warnings dey directed at citizens in southern Lebanon and di Bekaa Valley for di north east, say make dem stay far from areas wey Hezbollah fighters dey operate or hide weapons.

Lebanon information minister Ziad Makary also confam say dis one dey happen, as e tok for statement say “a large number of citizens in Beirut “don receive” unified random telephone messages via di terrestrial network, wey call on di respondent to comot from im place of presence”.

Di minister office also receive one of dis messages, di statement add. Makary describe am as part of a “psychological war” wey Israel dey carry out.

IDF say dem dey conduct strikes for southern Lebanon

Meanwhile, new statement from Israel Defense Forces say dem dey “conduct strikes on terror targets wey belong to di Hezbollah terrorist organization for southern Lebanon”.

Earlier, we hear from IDF tok tok pesin Rear Admiral Daniel Hagari, wey say di military go carry out more “extensive and precise” strikes for Lebanon.

E warn pipo to move away from Hezbollah targets “for dia own safety”.

Lebanon health ministry just recently confam say one pesin die for Israeli air strikes for di north of di Bekaa Valley.

Di strikes on di outskirts of Hermel also injure six pipo, two of dem seriously, according to di ministry.

Earlier, NNA report say one shepherd bin die outside di town of Bodai, wey dey di Hermel region.

A separate air raid on di town of Aitaroun, close to di Israeli border, injure 11 pipo , di ministry tok.

A timeline of how hostilities – fighting – continue to dey increase between Israel and Hezbollah recently

Pipo with coffin

Reuters
Crowd of pipo wey hold a coffin covered in yellow cloth

Fears of an all-out regional conflict for di Middle East bin increase in di past week after cross-border attacks involving Israel and Hezbollah intensify.

Dis na wetin don happen so far in brief:

  • On Tuesday, 12 pipo dey killed and thousands wound after pagers used by Hezbollah members explode across Lebanon.
  • Di following day, hundreds of walkie-talkies used by Hezbollah members explode, killing 27 pipo and e wound hundreds.
  • Hezbollah don blame Israel for di attacks, while Israel don decline to comment – though e dey widely assumed to be responsible.
  • On Friday, Israel say dem conduct an air strike for di neighbourhood of Dahieh, a Hezbollah stronghold for southern Beirut, killing a commander from di Iranian-backed militia and oda senior figures
  • Lebanon health ministry say 45 pipo, including three children, bin dey killed for dat strike.
  • Cross-border attacks continue over di weekend, with Hezbollah launching 150 projectiles into Israel, while Israel carry out air strikes into southern Lebanon wey dem say destroy thousands of di militia rocket launchers.

Source