Who dey behind di Bamako attack for Mali?

One military pick-up truck speeds through one road for Bamako, Mali capital city

Reuters
Tension dey Bamako sake of di attack attack

One al-Qaeda-linked group say na dem dey behind di early morning attack for Mali capital, Bamako.

Armed men bin target one military training school and oda areas for di city, authorities tok. For statement, army describe di attackers as “terrorists”.

Afta residents report say dem hear gunfire on Tuesday, di army say di attackers bin strike near di city airport but add say di situation now dey “under control”.

Jama’at Nusrat al-Islam wal Muslimin (JNIM) and oda groups don dey fight militant islamist insurgency for Mali for more dan a decade.

Di jihadist faction say dia “special operation” bin leave heavy human and material losses.

JNIM dey considered to be one of di most active militant groups for di wider Sahel region, afta dem stage numerous attacks for Mali, Burkina Faso and Niger.

“Early dis morning, a group of terrorists try to enta di Faladie gendarmerie school,” di army tok for dia statement.

Di school dey among a number of “sensitive points” “targeted by terrorist attacks” for morning, di security ministry tok.

Dem neva mention anytin about casualties. But, two members of di security forces tell tori pipo AFP say dem wunjure for di attack.

Di security ministry assure residents say dem go carry on wit dia activities as normal. Meanwhile, international organisations like UN don advise dia staff to restrict dia movement.

Videos wey dem post earlier on social media show black smoke wey dey rise from one part of di city.

As dem dey fire shots out out, pipo wey bin dey go mosque for morning prayers turn back, tori pipo Reuters tok.

Bamako Modibo Keita International Airport dey closed sake of di attack.

Di military seize power for coup for 2021, dem accuse di goment of failing to do enough to stop insurgency.

Di military pursue French troops and UN peacekeepers and bring in Russia Wagner group to help fight di jihadists, but e no dey like say di insurgency go end soon.

Wetin army tok?

Mali Army Chief of Staff Maj. Gen. Oumar Diarra say dem don neutralise di “terrorists” wey bin attempt to enta di gendarmerie school for di capital, but e no give update on di exact number of pill wey dem kill.

Im tok dis wen im visit di site of the attack, wia im say dem dey work behind di scene to get dia accomplices.

“We just all di terrorists wey we overpower hia. We dey torchlight di mata ,”Im tok.

“I go like ask pipo to provide us information. Dia support help for di arrest of suspects,” Gen. Diarra add put.

Photo for state TV show deadi dodi dem wey lie for ground wit weapons and protective gear wey dem display nearby. Several otda men wey dem present as suspects dem cover dia eye and tie dia hands as dem siddon for corner. Some of dem bin look injured.

Pipo claim say dem hear gunfire near di city airport for di capital during di day. Di JNIM jihadist group wey claim responsibility for di attack say e carry out operation wey also target a military airport.

Dem don temporally close di airport for Bamako sake of di incident. Di military say di situation now dey under control, and add say dem work out plans to track down more suspects wit di intelligence dem don gada so far.

Source