Daniel Dubois beat Anthony Joshua

Daniel Dubois shockingly knack Anthony Joshua in five rounds to carry im sef go global sporting glory in front of 96,000 fans for Wembley Stadium on Saturday.

Di 27-year-old drop Joshua many times to retain di IBF heavyweight title and leave im British rival career to scata.

Afta strong start, Dubois eventually stop Joshua wit better counter attack to secure di biggest win of im 24-fight career.

“Are you not entertained?” Dubois tok afta di fight to di hailing of di crowd for Wembley.

“I be gladiator. I be warrior to di bitter end. I wan reach di top level of dis sport and reach my potential.”

Daniel Dubois beat Anthony Joshua

Getty Images
Daniel Dubois beat Anthony Joshua

Reuters

Joshua bid to become a three-time champion and return to di division top table end in di way wey im no even expect.

AJ – wey win im first world title more dan eight years ago – suffer im fourth loss inside im 32nd bout.

Di 2012 Olympic gold medallist work imsef back into compulsory challenger status, but di dominant nature of Dubois win don leave ogbonge kwesion mark for Joshua body.

Dubois wey dey happy well-well enjoy di crowning moment wey im bin don dey eye since Oleksandr Usyk leave di belt.

Source