Edo state govnorship election result update

Edo election ballot box

BBC

Pipo of Edo state for Nigeria dey cast dia vote on who go become dia govnor for di next four years.

Sixteen men and one woman, 17 political parties na im dem dey contest for dis ogbonge position of govnor of Edo State.

However, sabi pipo say di race dey between only three of dem – All Progressives Congress (APC), di Labour Party (LP) and di Peoples Democratic Party (PDP).

Di Independent National Election Commission (Inec), Nigeria electoral body bin confam say more dan two million pipo don collect dia Permanent Voters Card (PVC), wey show dia readiness to participate for dis election.

Di gubernatorial election wey be one of di off-cycle elections for 2024, go take place across di 18 local goment area for di state.

Inec bin announce say accreditation and voting go begin at 8:30am and close at 2:30pm, provided say all voters wey bin already dey queue by 2:30pm go dey allowed to accredit and vote.

Di final step for di elections na di official announcement of election results by di electoral administrators.

Dis na how dem dey announce am for govnorship election according to Inec.

Di Presiding Officers go send results of di election to di RA Collation Officer.

RA Collation Officer go collate and send di result to di local government Collation Officer.

Di local government Collation Officer go collate di results and send to di State Returning Officer.

Di State Returning Officer go den collate di results from di LGA Collation Centres, and declare di result and return di winner as Governor elect for di state.

Candidate for di election to di office of Governor go dey declared winner if e get:

Di highest number of votes cast for di election; and

Not less dan one-quarter of all di votes cast in each of at least two-thirds of all di LGAs for di state.

Na afta all dis, di returning officer go declare di winner.

E fit take between one to three days depending.

For di last election for 19, September 2020, Inec declare di winner on 20, September 2020.

Move around di map to see who dey win which local government wen Inec begin announce am

Source