Details of long time ruler Ali Bongo letter to Gabonese as e officially wash hand comot from politics

Foto of Ali Bongo and im wife

AFP
Ali Bongo claim say dem dey torture im wife (wey dey dis foto) and son for detention

Former Gabon President wey dem comot from seat by force, Ali Bongo don announce say im don wash im hand comot from politics mata.

Im make dis announcement one year afta dem remove from power through military coup.

“I wish to reaffirm my withdrawal from political life and di definitive renunciation of any national ambition,” Bongo tok for letter wey im addressed to di Gabonese pipo.

Di 65-year-old also say make dem release im wife and son wey dey detention and awaiting trial sake of corruption allegations.

E no dey clear weda im statement follow any negotiations wit di military rulers, or if im dey hope say if im agree to comot hand from politics, im go fit secure di freedom of im family.

Oga Bongo bin suffer stroke for 2018 and pipo bin dey worried about im health during di build-up to di 2023 presidential election.

Di army bin seize power from Ali Bongo last August, shortly afta dem bin declare am winner of di election, wey di opposition no gree accept.

Im bin don lead di oil-rich kontri since 2009 wen im takeova from im papa.

Im papa sef bin don dey in power for more dan 40 years.

Di family bin get strong links to France, di pipo wey bin colonise Gabon.

How di coup bin happun?

Di coup, wey Gen Brice Oligui Ngeuma bin lead, make pipo happy well-well.

Pipo for Gabon bin dey celebrate for house while regional and continental bodies, even France bin condemn am.

One week afta di military takeova, dem release oga Ali Bongo wey dem comot from seat by force as president from house arrest. But im stay for di capital, Libreville.

Gen Nguema dey try to settle mata wit di former president, im tok say Ali Bongo dey free to go abroad.

But for im letter oga Bongo tok say im movements still dey restricted and dem dey monitor am evriday.

“My visits depend on di approval of di military. I dey cut-off from di outside world witout communications, witout news of my family,” im add.

Videos wey show suitcases of money afta di Gabon coup na true?

Gabon coup plotters get 15 years prison sentence for trying to remove President Ali Bongo

End di ‘violence and torture’ against my wife

Oga Bongo for di letter also tok say make dem end di “violence and torture” wey dem dey commit against im French-born wife Sylvia and son Noureddi. Im say make dem release dem.

Im wife and son dey for pre-trial detention sake of allegations of embezzling public funds.

Oga Bongo dey face charges of money laundering, forgery and di fake documents. She neva tok anytin for public since dem sama her wit di charges.

Her lawyer, Francois Zimeray, last year bin criticise her detention and dem quote am say im call her detention arbitrary and illegal.

Mr Bongo say both im wife and son na “helpless scapegoats”, im add say im decision to quit active politics also concern dem.

Di military authorities neva comment on Mr Bongo statement but dem bin deny previous claims say dem dey torture members of im family.

Bongo and im family dey face accuse say dem make demsefs rich at di expense of di nation during dia many years in power – but dem deny dis allegation.

Gabon na oil-rich kontri, but one third of di 2.4 million pipo dey live below di poverty line, according to di United Nations.

As im agree say im presidency no too dey smooth like dat, Bongo dey hope say di junta go end wetin dem call “national suffering” and im beg for national reconciliation.

“I understand say despite di achievements wey we do under my mandate, too many Gabonese pipo still dey suffer and dis na my greatest regret.”

Gen Nguema bn don promise say free and fair elections go dey wey go lead to di establishment of new civilian goment.

However, im neva publicly comment on weda im go contest for di presidency or not as dem dey plan to do di elections next year.

“I call on my kontri, di leaders and my fellow citizens make dem no accept vengeance and make dem write dia next history wit harmony and humanity,” Mr Bongo add,

Im vow say im no go be threat and im no go cause trouble during di transition of di kontri.

Source