Electoral commission confirm 13 presidential candidates for Ghana election

Di Ghana Electoral Commission don confam 13 presidential candidates wey go compete for di December 7 presidential election.

38 candidates bin tok say dem bin wan run for di election but na only 13 now fit compete.

Dis na as President Nana Akufo Addo presidential term go end for 7 January, 2025.

Expectation for di election be say e go hot sake of say former President John Mahama wey be 65 years old dey try come back to power and di 60 year old Vice President Mahamudu Bawumia.

Oda candidates include Alan John Kwadwo Kyerematen, Nana Kwame Bediako, Nana Akosua Frimpomaa and Akua Donkor.

Di two main contenders Mahama and VP Bawumia dey promise say dem go turn di economy around.

Di main opposition party bin run nationwide protest to demand forensic audit on wetin dem worry say be errors for di electoral roll.

But di electoral commission don tok say all di mistakes dem find for di recent voter exhibition dem don fix am.

As at 20 September, di electoral commission dey conduct ballot for di arrangement of names of candidates as dem go appear on top ballot boxes.

Make we find out who dem be in order wey dem go appear for ballot

EC conduct ballot for political parties & candidates

Political parties and independent candidates don pick position for di ballot paper for di 7 December Ghana elections.

Di governing new patriotic party candidate wey be di current vice president don pick number one for di ballot.

Di electoral commission bin organize di balloting afta dey announce say 13 candidates don qualify for di elections.

Dis na how di parties go show on top of di ballot paper on election day.

1. Dr Mahamudu Bawumia (NPP) – 1

2. Daniel Augustus Lartey Jnr (GCPP) – 2

3. Akua Donkor (GFP) – 3

4. Christian Kwabena Andrews (GUM) – 4

5. Liberal party of Ghana (LPG) – 5

6. Mohammed Frimpong (NDP) – 6

7. Nana Akosua Frimpomaa (CPP) – 7

8. John Dramani Mahama (NDC) – 8

9. Hassan Ayariga (APC) – 9

10. Kofi Koranteng (independent) – 10

11. George Twum-Barima-Adu (independent) – 11

12. Nana Kwame Bediako (independent) – 12

13. Alan Kyerematen (independent) – 13

Mahamudu Bawumia

Mahamudu Bawumia

Getty Images

Dr Mahamudu Bawumia na di current vice president for di kontri and don dey dat role to outgoing president Nana Akufo-Addo for two elections.

E be Deputy Governor of di Central Bank of Ghana until im nomination as Vice Presidential candidate for di New Patriotic Party (NPP) Presidential candidate Nana Akufo-Addo for 2008.

E also run as di vice-presidential candidate of di New Patriotic Party for Ghana 2012 general elections and di lead witness for di petitioners for di 2012/2013 Presidential Election Petition, wey challenge di of John Mahama as di winner of Ghana 2012 Presidential Election.

Daniel Augustus Lartey Jnr

Daniel Augustus Lartey Jnr dey run under su Great Consolidate Popular Party.

Di financial consultant bin work as company director for di British Eco Power Limited till October 2014.

Akua Donkor

She be di second female presidential candidate and she dey run under di Ghana Freedom party.

She dey run on di platform to create free port and to create policy wey go dey allow Ghana to refine crude oil

Christian Kwabena Andrews

Christian Kwabena Andrews dey run for di political party, Ghana Union movement.

Di pastor wey dem dey popularly call Osofo Kyiri Aboson tok say e dey run to bring back di spirit of Nkrumah.

Kofi Akpaloo

Kofi Akpaloo dey run under di Liberal party of Ghana.

E be accountant wey list im plan as creating Jobs. E bin once tok say, “evri pikin for Ghana go collect 200 cedis monthly child benefits”.

Mohammed Frimpong

Mohammed Frimpong dey run under di National Democratic Party wey e be chairman of.

Nana Akosua Frimpomaa

Nana Akosua Frimpomaa na di candidate of di Convention People’s Party.

For 2012 she run for Vice presidency for di same party as she also be di chairpesin of di party.

John Mahama

John Dramani Mahama bin dey run as Ghana President from 2012 to 2017.

Dis go be di second election e go contest for since im first lose to Akufo Addo for di 2016 presidential election.

John Dramini Mahama na Ghanaian politician, communication expert, historian, and writer wey dem born into politically active family for November 29, 1958.

E bin work as Member of Parliament for Bole Bamboi from 1997 to 2009 and Minister of Communications from 1998 to 2001.

John Mahama become vice president of Ghana for 2009 under John Evans Atta Mills, and later become president afta oga Mills die for July 24th, 2012 before e win di election dat same year.

Hassan Abdulai Ayariga

Hassan Abdulai Ayariga dey run under All People’s Congress (APC)

E bin dey work for Germany for ova 10 years bifor di businessman start im own business. For 2002, e join Ghana politics for Germany.

Kofi Koranteng

Kofi Koranteng na independent candidate wey be businessman.

Di 58 year old claim for im website say one of di tins wey im don do as advocate na to fight for di rights Ghanaians wey dey live abroad to fit vote.

As for im plans as president, one of im promises na to cut down goment spending as na only 20 ministers e go appoint to power.

George Twum-Barima-Adu

Oga Twum Barima Adu na anoda independent candidate wey show face say im go contest di election.

Im launch im campaign “to break di two-party governance for dis kontri”.

Im say im go cut public expenditure, deal wit illegal mining and ensure all goment contracts dey provide value for money.

Nana Kwame Bediako

Nana Kwame Bediako na 44-year-old business man wey dey run as Independent candidate.

E be one of di four independent candidates for di 2024 presidential election.

Dis na di first time e dey run for election

Even though e no get any goment experience bifor e ake inspiration from Ghana’s first president Dr Kwame Nkrumah and go deal wit unemployment for di kontri.

Alan John Kwadwo Kyerematen

Alan Kyerematen na di presidential candidate for di Movement of change party.

E be former minister of trade for di Akufo Addo administration.

E bin comot as di front runner of di New Patriotic Party (NPP) presidential race for September bicos according to am di support for VP Bawumia give am unfair advantage

Alan tok say im go unite di kontri and and build national agenda wit everybody inside – different from di way di NPP and NDC don run di kontri since independence.

Alan Kyerematen also tok say im goment go abolish levies on import of spare parts and oda items.

Source