Coronavirus in Nigeria: Kano record highest number of new cases of Covid-19 in one day

Latest coronavirus cases in Nigeria on Thursday 30 April reach 1932 wit di highest Covid-19 new confam cases for Kano wey record 80.

According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give around 11:50pm, di kontri record 204 new confam cases of Covid- 19 disease and e don enta 34 states of di federation and di federal capital territory.

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC

CASE SUMMARY FOR NIGERIA AS AT 29nd APRIL 2020

  • Total Confirmed cases – 1932
  • Discharged – 319
  • Death – 58

For inside dis new breakdown

80 fresh cases dey Kano meaning say Kano alone don get total of 219 cases

45 fresh cases for Lagos

12 fresh cases for Gombe

9 fresh cases for Bauchi

9 fresh cases for Sokoto

7 fresh cases for Borno

7 fresh cases for Edo

6 fresh cases for Rivers

4 fresh cases for FCT

4 fresh cases for Akwa Ibom

4 fresh cases for Bayelsa

3 fresh cases for Oyo

2 fresh cases for Delta

2 fresh cases for Nasarawa

I fresh case for Ondo

1 fresh case for Kebbi