Naira Marley speak again on Mohbad death and accuse say e be drug lord and cultist

Azeez Fashola aka Naira Marley don tok say im no get hand for di death of im former signee Ilerioluwa Aloba aka Mohbad.

For one statement wey im release on Tuesday night, Naira Marley tok say im also dey traumatised sake of di death of im former signee just like evri oda pesin dey traumatised.

Naira Marley tok say Mohbad bin leave di record label for September 2022 and add say di misunderstanding wey dem get no reach make of dem wish di oda pesin death.

“Truly, we get our own share of misunderstanding wen we dey work togeda, but di disagreement no reach wetin wey pipo dey paint. E no reach where we go wish each oda death,” Naira Marley tok for di statement.

E tok say dem bin dey resolve dia issues legally before Mohbad die.

Naira Marley tok say im dey shocked ova Mohbad death and di accusation wey im dey chop from pipo sake of di death also shock am.

Im say im decide not to say anytin sake of say im dey devastated sake of di death and sake of say im no wan jeopardise di investigation wey security agencies dey do.

Naira Marley also tok say im bin travel outside di kontri since 31 August 2023 and im neva return.

E say im dey make arrangement to return to di kontri sake of police invitation.

“I dey make arrangement to return to di kontri to assist di investigation and give my version of di event. I dey fully cooperate wit di police team and I no get any reason to be fugitive wen I no get hand for im death.

“I dey certain say di culprit wey dey behind di death get revenge against me and di pesin dey fuel public opinions so pipo go fit attack me for reasons wey only dem know,” Naira Marley tok.

E say im neva fight or attack Mohbad and im never instruct any pesin, friend, known associates or fans to attack, bully or harass Mohbad.

Naira Marley also tok say none of im artistes eva fight or mistreat Mohbad.

‘I no be drug lord and I no be cultist’

E also tok say di rumour say di record label na drug cartel or fraternity no be true. E say im no be drug lord and im no belong to any cult or fraternity.

“Marlian Music na independent label wey small intimate team dey run. We run legitimate label wey focus on championing exceptional talent, breaking new acts and nuturing dem,” Naira Marley tok.

E say im go prove im innocence on di case wit sufficient evidence.

Before now, Naira Marley bin issue statement to call for thorough investigation into di death of Mohbad.

Naira Marley describe di death of Mohbad as loss to evribody, say dem owe Mohbad all di assistance to help uncover any foul play or injustice.

Di 27-year-old singer die on 12 September and police and di Department of State Services dey currently investigate im death.

Dem exhume Mohbad deadi bodi days afta im die to perform autopsy on am. Nigerians dey wait for di autopsy result.

Di singer death still dey cause tok-tok for Nigeria and oda kontris since im death exactly two weeks ago.

Wetin to sabi about Mohbad

Mohbad na one of Nigeria rising musicians. Dem born am for Lagos State, southwest Nigeria for June 1996.

Di singer bin marry Nigerian woman simply identified as Wunmi and dem get one son togeda named Liam.

E bin sign under Naira Marley Marlian Music but e comot di label for 2022 in di middle of some controversies.

For inside one recent interview e do wit former Reality TV star Tacha wey also be radio host, Mohbad bin tok about im relationship wit Naira Marley.

Tacha share clips from di interview few hours afta tori of im death break.

E tok for di interview say, “ We just split from Marlian music to Imolenization, we just wan be on our own but e no come easy.”

E say e no easy but im dey find im way. E add say dem no dey fight and tins dey cool between dem.

Mohbad bin release im first album, Light EP for 2020. E dey popular for hit singles like Ponmo, Feel Good and Ko Por Ke wit Rexxie.

E also don do collabo wit artiste like Bella Shmurda, Small Doctor, Zlatan, among odas.

Source