Latest coronavirus cases for Nigeria: Di kontri record 195 new confam of Covid-19 cases

Latest coronavirus cases in Nigeria on Tuesday 28 April reach 1532 wit di highest Covid-19 new confam cases for Lagos wey record 80.

According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give around 11:50pm, di kontri record 195 new confam cases of Covid- 19 disease and e don enta 34 states of di federation and di federal capital territory.

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC

CASE SUMMARY FOR NIGERIA AS AT 22nd APRIL 2020

  • Total Confirmed cases – 1532
  • Discharged – 255
  • Death – 44

For inside dis new breakdown

80 fresh cases dey Lagos meaning say Lagos alone don get total of 844 cases

38 fresh cases for Kano

15 fresh cases for Ogun

15 fresh cases for Bauchi

11 fresh cases for Borno

10 fresh cases for Gombe

9 fresh cases for Sokoto

5 fresh cases for Edo

5 fresh cases for Jigawa

2 fresh cases for Zamfara

1 fresh case for Rivers

1 fresh case for Enugu

1 fresh case for Delta

1 fresh case for FCT

1 new case for Nassarawa