Guinea-Bissau vs Nigeria- Live updates of Super Eagles Afcon qualifiers match

Guinea Bissau dey play Nigeria for di second time in three days for di African cup of nations qualifying match on Monday evening.

Last week dem shock di three time African champions to beat dem 1-0 for Abuja.

Di victory move di Djurtus top of group A wit seven points, ahead of Nigeria.

Only di top two teams from each group go qualify for Afcon 2023 wey go take place for Ivory Coast.

Sierra Leone and Sao Tome na di oda teams wey dey di group.

Follow us for di match build up and live text.

First half

Game go soo start

Guinea Bissau vs Nigeria line up

Nigeria XI: Francis Uzoho; Semi Ajayi, Kenneth Omeruo, Bright Osayi-Samuel, Zaidu Sanusi; Alex Iwobi, Frank Onyeka; Moses Simon, Terem Moffi, Samuel Chukwueze, Victor Osimhen.

Guinea Bissau vs Nigeria build up

Dis na di di third meeting between di two kontries since 2022.

Di first time dem meet na for di 2021 Afcon finals for Cameroon, Super Eagles win 2-0 win.

Nigeria coach, José Peseiro neva win in last four games in all competition.

Currently, na Guinea Bissau dey lead Group A wit seven points, one point more than Super Eagles.

Meanwhile Sierra Leone get five points afta dem win against Sao Tome & Principe on Sunday.