Di collation of di governorship election result for Abia state still dey on hold three days afta di election wey hold on Saturday 18 March.
Di collation of di result bin dey go well until di State returning officer Professor Nnenna Otti put am on hold sake of directive by di Independent National Electoral Commission (Inec).
On Monday, Abia state electoral officer announce di suspension of di election results on till Tuesday.
According to Prof Nnenna, dem get di order from Inec national headquarters to suspend collation of results from Obingwa local goment area of di state afta jaguda pipo invade dia office.
Since di suspension of collation of results nobody don hear anything from di electoral body.
As at Monday 20 March Inec don collate results from 16 out of di 17 local government areas of di state – di only remaining LGA na Obingwa.
Afta di collation of results for 16 council areas, Labour Party candidate Alex Otti dey score 172,246 votes while im closest challenger, Okey Ahiwe of di PDP dey poll 78,628 votes.
Di difference between di LP and di PDP candidates na 93,618 votes.
Wetin dey happun for Obingwa Local government area
From di results wey Inec don collate; Abia North, Abia South, Arochukwu, Bende, Ikwuano, Isuikwuato, Ohafia, Umuahia North, Umuahia South and Umunneochi na di 10 LGAs wey LP don win.
Di PDP candidate on im part don Isiala-Ngwa South, Ukwa East, Ukwa West, Ugwunagbo, and Isiala-Ngwa North, according to Inec.
Di YPP candidate, Eyinnaya Nwafor win only Osisoma LGA – wia im come from.
All di parties now dey wait for di result of Obingwa LGA wey get 157, 390 registered voters, according to Inec data.
Out of dis 157, 390 na only 154, 966 voters collect dia Permanent Voters Cards for di 2023 election.
On Sunday, Inec raise alarm say jaguda pipo don attack di collation centre for Obingwa wey dey happun for council secretariat.
Tori be say some politicians dey try do mago-mago wit di result for Obingwa wey fit determine di winner of di governorship election.
To save di situation Inec announce suspension of di collation of di result for Abia state.
As tins be, Abia pipo dey wait to hear form Inec on dia decision wey dem don take on di governorship election result for Obingwa Local goment area.