Millions of Nigerians dey vote for wetin some sabi pipo say be di most competitive general elections since military rule end.
Nigerians dey vote to elect govnors and also lawmakers into di state house of assemblies.
Na 18 political parties go participate for di polls and unlike di presidntial election, na only 28 out of di 36 states of di federation go participate.
But asides di govnorship election wey go be for 28 states, elections for members of state assemblies go happun for all di 36 states of di kontri.
According to di Independent National Electoral Commission, Inec, 993 State Houses of Assembly seats na im dey up for grabs.
Na 25 local goment areas dey Delta state wey be di commercial capital of Nigeria.
Unlike di presidential election, na Inec resident electoral commissioners for each state go call di winner and results for di state afta dem collate at di local goment level and bring to di state collation centre.