Turkey earthquake: Video show buildings destroyed as 1,700 die for south-east Turkey near Syria border

Watch: Searching for people in earthquake rubble in Malatya
The British Broadcasting Corporation

Schools for di 10 cities and provinces across Turkey wey di earthquake affect go dey closed for one week, di kontri vice president Fuat Oktay tok.

Di cities and provinces na Kahramanmaraş, Hatay, Gaziantep, Osmaniye, Adıyaman, Malatya, Şanlıurfa, Adana, Diyarbakır, Kilis.

Oktay also tok say dem don suspend flights wey wan enta or comot di airport for Hatay province, dem don also close di airports for Maraş and Antep to civilian flights.

Dis dey come afta more dan 1,700 pipo die and many odas dey trapped inside as one powerful earthquake hit one wide area for south-eastern Turkey, for near di Syrian border.

Turkish Vice-President Fuat Oktay say di death toll for Turkey now don rise to ova 1,700 pipo.

For Syria, more dan 783 pipo don die according to state media report.

Di Syrian health ministry say pipo bin die for di provinces of Aleppo, Latakia, Hama and Tartus.

Di US Geological Survey say di 7.8 magnitude tremor strike at 04:17 local time (01:17 GMT) at a depth of 17.9km (11 miles) near di city of Gaziantep.

Watch: Video shows destruction after Turkey’s earthquake
The British Broadcasting Corporation

UK-based Syrian Observatory for Human Rights don update dia preliminary death toll to 783 for di whole of Syria.

Meanwhile help don dey come di way of Turkey in di wake of di earthquake incident, Dutch PM Mark Rutte don announce say one Dutch search and rescue team go join di hunt for survivors for Turkey and Syria. For inside one tweet, e also share im condolences to Turkey president Erdogan, saying: “Thoughts dey wit all victims of di serious natural disaster.”

Greek Prime Minister, Kyriakos Mitsotakis, say Greece go also “mobilise dia resources” and assist di affected areas “immediately”.

Di leaders of Serbia and Sweden don also promise to send help to di region.

Israel foreign minister Eli Cohen say dem don arrange one fast aid programme. Dia defence minister Yoav Gallant say Israeli security forces dey ready to offer any assistance needed, Reuters report.

Some parts for Israel and di Palestinian territories also feel di tremors from di quake.

For Turkey, officials bin confam more more dan 76 deaths and 10 cities wey dey affected, including Diyarbakir.

Fears dey say di death toll go rise sharply in di coming hours.

Many buildings don collapse and dem don send rescue teams to go search for survivors under big pile of rubble.

Rescue teams check one destroyed house for Diyarbakir, Turkey. Photo: 6 February 2023

Anadolu Agency via Getty Images
For Diyarbakir north-east of Gaziantep rescuers still dey search for pipo wey dey trapped for collapsed buildings

Turkish Interior Minister Suleymon Soylu say 10 cities dey affected: Gaziantep, Kahramanmaras, Hatay, Osmaniye, Adiyaman, Malatya, Sanliurfa, Adana, Diyarbakir and Kilis.

As at di time of dis report, tori be say at least 2,323 pipo injure for Turkey and 639 for Syria.

One BBC Turkish correspondent for Diyarbakir, report say one shopping mall for di city don collapse.

Turkey earthquake map

BBC

Pipo for Lebanon and Cyprus also feel di earthquake.

“I bin dey write sometin and just all of a sudden, di entire building start dey shake and yes I no really know wetin to feel,” Mohamad El Chamaa, one student for di Lebanese capital Beirut, tell BBC.

“I dey right next to di window so I just dey fear say dis window fit break. E go on for four-five minutes and e dey bad well-well. E dey mind-blowing,” e tok.

Rushdi Abualouf, one BBC producer for di Gaza Strip, say di house wia e dey stay shake for about 45 seconds.

Smashed cars under one destroyed building for Malatya, Turkey. Photo: 6 February 2023

Anadolu Agency via Getty Images
For Malatya, also north-east of Gaziantep, cars dey smashed by collapsed buildings

Turkish seismologists estimate di strength of di quake to be 7.4 magnitude.

Dem tok say dat na di second tremor wey go hit di region just minutes later.

Turkey lie for one of di world’s most active earthquake zones.

For 1999, more dan 17,000 bin die afta one powerful tremor bin rock di north-west of di kontri.

Pipo dey search for survivors afta one building collapse for Hama, Syria. Photo: 6 February 2023

Sana via Reuters
For northern Syria, di quake flatten some buildings for di city of Hama