“I swear to challenge di ruling for di Court of Appeal.”
Dis na di reaction of di Osun state govnor, Senator Ademola Adeleke afta di election tribunal wey siddon for Osogbo, di state capital nullify im govnorship position.
Di govnor for inside statement wey im tok-tok pesin Mallam Olawale Rasheed sign say di judgement of di tribunal na “miscarriage of justice” and im go challenge di judgment for di Court of Appeal.
Di Osun State governorship election petition tribunal bin declare Gboyega Oyetola as winner of Osun govnorship election wey happun for July 16, 2022.
Di tribunal wey justice Tertsea Kume lead say na di former govnor be di winner of di election.
Governor Adeleke wey react to di decision of di election tribunal from im kontri home for Ede fault di resolution of di over-voting question in favour of oga Oyetola, e say na “an unfair interpretation against di will of majority of voters”
“I call on our pipo to remain calm. We go appeal di judgement and we dey sure say we go get justice. Make our pipo dey reassured say we go do everything possible to retain dis widely acclaimed mandate”, Governor Adeleke declare.
- Tribunal declare Gboyega Oyetola as winner of Osun govnorship election
- How Adeleke win Osun govnorship election
Tribunal reduce Adeleke votes
Di electoral body announce Ademola Adeleke as di winner of di governorship election wit 403, 271 votes and Gboyega wey bin dey contest for second term get 375, 027 votes.
Di former govnor ask di tribunal to nullify di election, ontop accuse say mago-mago, say dem rig votes for some polling units.
E also challenge di authenticity of di West African Examination Council (WAEC) certificate wey Governor Adeleke present among oda tins.
Na Justice Tersea Kume head di three-man election petitions tribunal on January 13 and adjourn indefinitely for judgement afta parties for di petition adopt dia final written address.
Afta di deduction di tribunal say Oyetola poll 314,931 while Adeleke poll 290,266 votes.
One judge no gree
Na three judges dey make up election petition tribunal according to Nigeria judicial Law.
Out of di three judges wey rule on di mata, two agree wit di petitioner say over voting happun while one Judge no gree.
Di Judge wey no gree na Justice Benefit Ogbuli – e disagree wit di majority judgement by di chairman say di petitioner neva prove im case well. Di Judge dismiss Oyetola petition.
Lawyer to di petitioners, Saka Layonu SAN commend di panel for delivering di judgement well and in favour of di petitioners.
Layonu say “Tribunal don tok dia own. Make pipo remain calm as far as dis mata dey concerned.
“Wen dem declare Adeleke winner pipo no protest so we expect dat same composure from di supporters of di incumbent governor.
“Di PDP get chance to appeal di matter.”
PDP and Adeleke Lawyer, Nathaniel Oke tell di panel say as tins be na two judgements dey and both the petitioners and respondents get di right of appeal.
“We no dey happy wit di judgement. Di minority judgement na di one wey we dey hold and we go take di necessary steps to challenge di tribunal,” e tok.
Wetin go happun next?
According to di Electoral Act, afta di conduct of election for Nigeria, any pesin or party wey no dey happy wit di process or wey get complain wit di outcome of di election fit petition Election Tribunal to chook eye into di electoral process.
- Di Election Tribunal dey provide avenue for aggrieved contestants or political parties to seek redress under di law.
- All actions wey arise from di conduct of an election go start by di way of petition. Di aggrieved pesin must file Election Petition within 21 days afta di Independent National Electoral Commission (Inec) declare di result of di election. If di petitioner fail to file di petition within 21 days, e go lose im right of action.
- An Election tribunal must also deliver judgement in writing within 180 days from di date dem file di petition.
- Di affected pesin or party must appeal di decision of an Electoral Tribunal within 60 days from di date wen di tribunal deliver di judgement.
- Di time frame wey di tribunal or court go deliver di judgement dey strict and dem no dey extend am.
- Di Appeal and di Supreme Court get 180 days to hear di petition and deliver on di outcome of di election tribunal ruling.
Following di Osun State Governorship Election Petition Tribunal wey nullify di victory of Ademola Adeleke as Osun state govnor for di election wey hold for July 16, 2022, one lawyer, Jiti Ogunye wey follow BBC Pidgin tok say di tribunal judgement no mean former govnor, Gboyega Oyetola go immediately assume power for Osun state.
E say di govnor go still remain for office until di time e appeal di case and if e dey dissatisfied wit di judgement of di Appeal court, e still fit carry am go Supreme Court.
“E go still remain for office as di court proceedings dey happun, na afta di Supreme court ruling, if e no favour am, na dat time e go fit comot for office.
“E get 180 days from di day of di election tribunal to seek redress for Appeal and Supreme Court,” e tok.
Oga Ogunye say if di govnor no appeal di case within di duration of time wen e get to appeal, e mean say dem go swear in di winner.
But if e appeal within di time frame, e go kontinu to stay in goment as di govnor until di mata dey decided by di appeal tribunal in di first instance and di Supreme Court in di second instance.
Reactions
Mixed reactions na im greet di judgement of di Osun State govnorship Election Tribunal wey nullify di election of Ademola Adeleke and declare Gboyega Oyetola as govnor for di July 16 2022 election.
As some pipo hail di judgement say na beta tin for democracy, odas tink say di decision no dey fair.
Ondo State govnor Rotimi Akeredeolu dey among dos wey hail di decision of di tribunal.
E say na victory for democracy plus di judgement go further consolidate and deepen di kontri democratic values and elections petitions jurisprudence.
I congratulate my dearest brother, Alhaji Gboyega Oyetola (Ileri-Oluwa). I also rejoice with the good people of Osun State and the entire APC family. This is a victory for all.
— Arakunrin Akeredolu (@RotimiAkeredolu) January 27, 2023
‘Di tin dey sweet me’, Oyetola
Former govnor Gboyega Oyetola and im party APC say di ruling of di tribunal make sense.
Di petitioner say, “I dey happy say di judgement don resolve di controversy about di winner of di July 16 election in di state.
“INEC na di greatest beneficiary of di judgement as e go give INEC di opportunity to look all di anomalies and make amendments to avoid repetition for di general elections wey dey come soon.”
E thank di pipo of di state and im supporters for dia courage and loyalty.
Gboyega give assurance say im dey ready to serve dem.
OSUN TRIBUNAL VERDICT: CONGRATULATIONS, GOVERNOR OYETOLA
The Election Tribunal’s verdict represents victory for democracy and the rule of law. It is a categorical affirmation of the will of the Osun electorate as expressed at the polls. pic.twitter.com/cCqg2gPqx9
— APC Nigeria (@OfficialAPCNg) January 27, 2023