Teams wey don arrive Qatar for Fifa World Cup 2022

England team

Getty Images

Teams don begin arrive Qatar, ahead of di first ever edition of di Fifa World Cup for dia.

Na 32 teams go compete for di tournament and dem dey in eight groups of four.

Di tournament go officially begin on Sunday November 20 and end December 18.

For di first time in di 22 editions, di tournament go happun for winter.

Fifa make dis move to avoid to play for summer sake of heat during dat period.

Checkout some of di teams wey don show for di Middle East kontri.

Senegal

Getty Images

Senegal

Senegal

Getty Images
 Dis na Senegal national team for Hamad International Airport after dem land Doha, Qatar for World Cup

USA 

USA

Getty Images
Team USA wey dey Group B, na one of di first teams to arrive Qatar for di World Cup

South Korea

South Korea

Getty Images
South Korea wey dey Group H land Qatar on Sunday

Australia

Australia

Getty Images
Australia team aka Socceroos smile as dem announce dia arrival for Qatar

Tunisia

Tunisia team

Getty Images

Iran

Iran

Getty Images
Na Qatar airways plane carry Iran team go World Cup

Switzerland

Switzerland

Getty Images
Switzerland players leave dia plane afta dem land for Hamad International Airport

England

England

Getty Images
England team – Di three Lions don land

Ecuador

Ecuador

Getty Images
Most of di South American players wear T-shirts fall in Qatar

Netherlands

Netherlands

Getty Images
Di Dutch boys dey look sharp wit dia Suit

Denmark

Denmark

Getty Images
Checkout di Danish team

Wales

Wales

Getty Images
Dis na Wales first World Cup in 64 years

Qatar 2022 World Cup groups

Group A: Qatar, Ecuador, Senegal, Netherlands

Group B: England, Iran, USA, Wales

Group C: Argentina, Saudi Arabia, Mexico, Poland

Group D: France, Australia, Denmark, Tunisia

Group E: Spain, Costa Rica, Germany, Japan

Group F: Belgium, Canada, Morocco, Croatia

Group G: Brazil, Serbia, Switzerland, Cameroon

Group H: Portugal, Ghana, Uruguay, South Korea

World Cup format and schedule explanation

Four matches go take place every day during di group stage, e go last for a 12-day period.

Di winners and di pipo wey finish second go qualify for di round of 16.

Just like Afcon, World Cup get third place match.

Di third place match go take place for December 17.

Which stadiums go host di World Cup matches?

Di group games go take place across eight stadiums wey be:

  • Al Bayt Stadium
  • Khalifa International Stadium
  • Al Thumama Stadium
  • Ahmad Bin Ali Stadium
  • Lusail Stadium
  • Ras Abu Aboud Stadium
  • Education City Stadium
  • Al Janoub Stadium