Keke rider wey carry hyena wey try escape ‘na wanted man’ for Kano

KAROTA say hyena no be sheep or goat and no suppose dey inside keke

Getty Images

Tok tok pesin for Kano Road Traffic Agency (KAROTA) Nablisi Abubakar tell BBC News Pidgin say dem dey look to arrest keke rider wey carry di hyena wey bin try to escape for Wapa market inside Kano city.

“Di keke rider dey wanted at dis time because wetin im do dey against di law, e no suppose carry wild animal inside keke.”

“Hyena no be sheep or goat, dis na dangerous animal wey no suppose roam among pipo and certainly keke no suppose carry.”

“We dey investigate di keke rider at di moment we don get two numbers of keke wey be suspects and if we get di pesin na court straight.” Dis na wetin Nablisi tok.

Wapa na popular market for Kano wia exchange of currencies dey happun and for Thursday afternoon as pipo dey go about dia normal activities na im wild animal hyena wey bin dey inside one keke try escape comot as di owner wey be passenger lose control of di animal in di middle of di market.

Na so some pipo begin run for safety inside di market as di animal begin enjoy im minutes of freedom.

Chairmo of di market Hussaini Abdullahi wey also be eye witness tell BBC News Pidgin how di incident happun for Thursday afternoon.

“Di thing happun for Thursday afternoon after we pray finish, di keke wey carry di hyena dey try pass when di thing wey di owners use cover di hyena mouth comot.”

“Na dat one make pipo gather dey watch while some dey fear run comot some gather to watch wetin dey happun, so di truth be say di animal no pursue pipo.”

“Di owners lose control of di animal and dat mouth covering comot na dat make pipo fear but dem later gain control and cover di hyena mouth before dem carry am go.”

Hussaini say dem no sabi di keke rider wey be wanted man at di moment because na pass e come pass no ne dia usual person.

‘Na wild animal trafficking wey deserve punishment’

Nura Lawal na manager of di biggest zoo for northern Nigeria, Kano Zoo and e tell BBC News Pidgin say dem make attempt to tame and arrest di hyena owners after dem hear about wetin happun unfortunately by di time dem reach dia di pipo don leave.

“As soon as we hear about di hyena we send our pipo wey be experts to go dia go tame di animal but by di time dem reach di pipo don leave.”

“Wetin dem do dey against di law because na traficking and e dey punishable by law.”

“Assuming we get dem we for arrest and prosecute dem for wetin dem do.”

Di manager add say di fact say dem carry hyena inside keke instead of special transport arrangement wey wild animals deserve show say dem no sabi how to treat those kain animals.

Hausa culture and hyenas get long history

Anybody wey grow up for northern Nigeria sabi wetin Hausa pipo dey call ‘wasan kura’ wey stand for Hyena play.

For many years and till date e get traditional melecine pipo wey get hyenas and dem use dem to grab attention in order to advertise dia products.

Shuaibu Sani na social commentator for Kano and e tok say dis na age long practice wey suppose come to an end considering how dangerous e be.

“Dis particulat incident for Wapa market and odas in di past show say hyenas fit escape and na wild animal wey get ability to kill human beings.”

“So goment suppose act to stop ‘Wasan Kura’ and ban hausa trado melecine pipo wey still dey use hyena to advertise dia goods.”