‘E sweet my belle’- Buhari hail NDLEA cocaine burst for Lagos

President Muhammadu Buhari don congratulate di chairman of di Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), Brig Gen Buba Marwa (retd) afta di agency seize crack wey worth 193 billion naira.

Di agency bin report say dem seize about 1,855kilograms of cocaine and arrest drug barons afta dem raid one warehouse for Ikorodu area of Lagos, southwest Nigeria.

For di call to di chairman of di anti-narcotics agency from New York where im dey attend di 77th session of di United Nations General Assembly (UNGA 77), President Buhari tell Marwa say dis kind news sweet im bele and tok say im appreciate di work wey di agency dey do.

“You don demonstrate ova and ova again say na good choice I make to choose you to lead dis fight against wicked merchants of death wey dia aim na to endanger and cut short di future of our youth. Please continue to dey do di good work,” Buhari tok.

How NDLEA burst cocaine warehouse for Lagos
The British Broadcasting Corporation

How NDLEA burst cocaine warehouse for Lagos

NDLEA for di venue

BBC

Di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA say dem don burst one major warehouse for one estate wey dey inside Ikorodu area of Lagos.

For wetin di agency dey call di ‘biggest’ singular cocaine seizure in di history of Nigeria anti-narcotic agency, di operatives say dem seize 1.8tons (1,855 kilograms) of di illicit drug worth more dan Two Hundred and Seventy Eight Million Two Hundred and Fifty Thousand Dollars ($278, 250,000) equivalent of about One Hundred and Ninety Four Billion, Seven Hundred and Seventy Five Million (N194, 775,000,000) Naira in street value.

Authorities arrest at least, four drug barons including one Jamaican and di warehouse manager in di well coordinated and intelligence led operation wey last two days across different locations for Lagos state.

Authorities say dem all be members of an international drug syndicate wey di Agency don dey trai since 2018.

Authorities raid di warehouse wey dey 6 Olukuola crescent, Solebo estate, Ikorodu, on Sunday 18th September, 2022, while de pick up di barons from hotels and dia hideouts in different parts of Lagos between Sunday night and Monday 19th September.

Preliminary investigation reveal say di class A drugs dey warehouse for di residential estate from wia di cartel bin dey try to sell dem to buyers for Europe, Asia and oda parts of di world. Dem store dem inside 10 travel bags and 13 drums.

NDLEA, oga Brig. Gen. Mohamed Buba Marwa (Retd) commend all officers and men of di Agency wey get and for di extensive investigation including those of di American Drug Enforcement Administration, (US-DEA), e also say di bust na historical blow to di drug cartels and a strong warning for odas.

Boxes dem see for di warehouse

BBC
Some of di cocaine wey NDLEA bust

BBC