Kano Court sentence school owner to death for murder of Hanifa Abubakar

High court for Kano don sentence Abdulmalik Tanko wey be proprietor of Noble kids academy to death by hanging for di murder of im 5 year old student Hanifa Abubakar wey happun for January.

Judge Sulaiman Na Abba also sentence Hashim Isyaku wey help bury her remains to death by hanging.

While di third accused, Fatima Musa get one year imprisonment for her role as judge say she also bin attempt to kidnap Hanifa.

How di judgement day be for court

Na from morning of di case court room full as plenti tori pipo and oda residents of Kano wey begin follow di case since e start troop in to witness how e go end.

Security pipo also full ground to make sure say everything go smoothly without any issue.

Small delay bin dey to start di case as di judge wey arrive late apologise and give im reason say e go change im voter card location in preparation for next year election.

Di judge bin start by reviewing all wetin don happun for court over di last six months, spending hours reading out all di testimonies from pipo wey take stand for court.

On di oda hand, Hanifa papa and mama and oda family members siddon inside court dey wait for judgement.

Na after di judge finish im review e begin read out di sentences wia e convict di first and second accused – Abdulmalik Tanko and Hashim Isyaku of four of di five charges against dem.

Di charges na criminal conspiracy, kidnap, murder and concealment of corpse na for only abeitment charge di court no convict dem.

Justice Na ‘abba give Abdulmalik and Hashim opportunity to speak before dia sentencing and both delegate dia lawyer to speak for dem.

Di lawyer beg court to tamper justice with mercy as Abdulmalik na family man while Hashim na di only breadwinner of im family.

Di prosecuting team wey dey led by di commissioner of justice for Kano, Musa Lawal, beg di judge for maximum sentence as dem tok say Hanifa family deserve justice for wetin happun to dia pikin.

‘Alhamdulillah’

Na after di judge begin read wetin dey on di white paper wey dey in front of of am wey carry di sentences.

Immediately after e finish Hanifa mama shout ‘Alhamdulillah’ wey for Arabic mean ‘ I thank God’ for di judgement.

Security pipo hurriedly rush di convicted pipo out of court.

E no dey clear wetin di defence go do next but Nigerian laws give dem up to 30 days to appeal di judgement wey high court give.

Hanifa Abubakar murder case – Background

Since news of Hanifa alleged murder break for January 2022, #Justiceforhanifa trend on on social media in Nigeria.

Hanifa death trend for social media afta police discover di remains of Hanifa inside Northwest Preparatory school for Tudun Murtala area of Kano city.

Dat na school wey she dey attend and dem arrest three pipo over di case including her teacher.

President Muhammadu Buhari join oda Nigerians to condemn di alleged murder of di five-year-old school girl Hanifa Abubakar.

Alhamdulillah