PDP Presidential Primaries 2022: Atiku Abubakar get Peoples Democratic Party ticket but e go fit win di 2023 elections?

Former Nigeria Vice President Atiku Abubakar don win di main opposition party of Nigeria, Di Peoples Democratic Party, PDP, dia presidential ticket to represent di party for di 2023 elections.

Atiku get 371 votes to defeat di oda aspirants dem and im closest challenger, Govnor of Rivers state, Nyesom Wike wey get 237 votes.

Atiku for im acceptance speech say im go make sure say unity dey for Nigeria and give all citizens sense of belonging irrespective of wia dem come from or di religion dem dey practice.

E also tok say im go deal decisively wit di kontri security, economic challenge wey dey face di kontri.

Tinubu, odas congratulate Atiku

Meanwhile di APC national leader and presidential aspirant Bola Tinubu don congratulate Atiku on im victory. For im own message say:

“I welcome di victory of Alhaji Atiku Abubakar as di candidate of di Peoples Democratic Party for di just concluded primary.

I look forward to square up wit am as one worthy opponent for di coming election, e add for statement.

Ogbonge Nigerians don dey drop dia congratulations for Atiku Abubakar domot.

Govnor Duoye Diri of Bayelsa state for im facebook page say, “I congratulate Alhaji Atiku Abubakar on im emergence as presidential flag bearer of our party PDP, afta our succesful primaries”.

Also Governor Godwin Obaseki for inside statement, say “I heartily congratulate his Excellency, Atiku Abubakar (GCON) on im victory for di Peoples Democratic Party Presidential primary election.

E add say, “di keenly contested process of picking flagbearer for our great party don again show say PDP as party wey don enthrone one transparent internal democratic process be wetin our nation now desperately need for im much -desired rebirth”.

Atiku Abubakar go dey lucky di sixth time around?

Atiku Abubakar no be visitor for di contest for Nigeria president. seat as im don try im luck five times before now but e no win.

But recently for one interview, di former vice president wey bin serve wit Former President Olusegun Obasanjo dat time say im get hope say e go win di presidential race come 2023.

Di reason wey im give be say e bin contest Adamawa governor seat four times bifo im win di fourth time.

For 1993, e bin contest for di Social Democratic Party presidential primaries and lost to Moshood Abiola and Baba Gana Kingibe.

Oga Atiku be contest for president under Action Congress for 2007 wia e lost to Umaru Yar’Adua of PDP .

For 2011 oga Atiku bin contest di presidential election wit former President Goodluck Jonathan but e loose.

For 2014, e join di All Progressives Congress to participate for 2015 presidential election but e bin loose to Muhammadu Buhari for primaries.

For 2017, oga Atiku bin return to di Peoples Democratic Party.

For 2019, Atiku bin run di presidential race as PDP candidate and loose to President Muhammadu Buhari wey contest under di All Progressives Congress.

Meanwhile, na afta e fail three times, na im President Buhari too finally realise im dream on im fourth try to become di president of di Federal Republic of Nigeria.

Yemi Osinbajo

Getty Images
Nigeria vice president dey eye di seat of di president for 2023

Di major opponents wey Atiku Abubakar fit likely face for 2023

As di race for who go become Nigeria president for 2023 continue, Nigerians still dey wait di ruling All Progressives Congress party, APC, to run dia presidential primary election so dem go fit sabi who be di pesin wey go dey di race for dem.

Among di aspirants for APC na di party National Leader, Bola Tinubu, Nigeria Vice President Yemi Osinbajo and di Minister of Transportation Rotimi Amechi among odas.

Peter Obi na anoda pesin wey go stand as ogbonge opposition for im ambition if e become di presidential flagbearer for di Labour Party afta e defect from PDP.

Wetin to know about Atiku

Dis na di sixth time former vice-president Atiku Abubakar dey try im luck to be Nigeria president.

Im come from Adamawa state, Northeast Nigeria.

Atiku na businessman and politician. E contest to be govnor of Adamawa state two times. First, for 1990 and di second time na for 1998 before im become vice presidential candidate for 1999.

For 1993, im contest di presidential position for Social Democratic Party presidential primaries wia im lose to Moshood Abiola and Baba Gana Kingibe.

At 74, Atiku Abubakar still believe say im deserve di opportunity to rule Nigeria.

Of all di aspirants from di PDP, Atiku na di oldest of di candidates and many pipo bin tok say im no get fresh ideas for di kontri.

But Atiku get experience as one of di politicians wey bring PDP come for 1999.

Even though im comot to join di opposition, like prodigal pikin im return to PDP.

During im declaration, Atiku say if im win im go focus on five key areas of unity of Nigeria, security, economy, education and to carry resources and powers give federating units.