Nnamdi Kanu: Court strike out amended charge wey FG bring against Ipob leader

"Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] 'Nnamdi Kanu extradition arrest' in Nigeria ', go appear for Nigeria court - 'Abubakar Malami'

Getty Images
Nnamdi Kanu na im dey operate Radio Biafra

Di Federal High Court Abuja don strike out di newly amended six-count charge wey di Federal Goment sama Nnamdi Kanu

Justice Binta Nyako strike out di charge following di Federal goment withdrawal.

Di withdrawal come afta Kanu lead counsel Mike Ozekhome complain to di court say di prosecution dey try to delay processes by continuous amendment of di charge against im client.

Ozekhome tell di court say dis na di seventh time di FG dey amend im charge.

Justice Nyako gree to Ozekhome submission say Kanu no dey expected to take plea on di newly amended charges immediately, as e need time to digest dem before doing so.

Court deny Nnamdi Kanu bail

Di federal high for Abuja don refus to grant di detained leader of di Indigenous People of Biafra, IPOB, Nnamdi Kanu, bail.

Di presiding judge, Justice Binta Nyako for her ruling on Wednesday say di bail application dey premature and therefore deny Kanu bail.

Mike Ozekhome, wey be Kanu lead counsel bin move one ogbonge application wey ask di court to grant Kanu bail

E say until di court try pesin and fin am guilty, he suppose dey allow to waka freely and dat Kanu suppose enjoy innocence until dem prove am guilty

E also beg di court make dem grant am bail sake of say e no well .

Wetin happun for di last hearing

Justice Binta Nyako reduce charges against Nnamdi Kanu

For one major ruling, di trial Judge for di Federal High Court drop eight (8) out of di fifteen (15) charges wey Nigerian goment bin sama against Nnamdi Kanu.

Di eight charges dey among recent offenses wey dem add to di charges against di separatist leader.

Justice Binta Nyako of di federal high court as e dey dismiss di charges rule say Counts 6, 7, 8, 9, 10, 11, 12, and 14 dey incompetent for not disclosing any offence against di defendant.

She come rule say Counts 1, 2, 3, 4, 5, and 13 and 15 disclose valid charges against Nnamdi Kanu.

Issue of Nnamdi Kanu kidnap or abduction alias rendition come up for Court

Mike Ozekhome, SAN wey dey lead Nnamdi Kanu team of lawyers, tell di court say im client experience “unlawfully, brutally and extraordinarily renditioned from Kenya without e consent”.

Di “Kidnap” or “abduction” na wetin dem dey call extraordinarily renditioned for legal language.

Dat na to capture or forcefully take someone from anoda kontri to come face persecution for im own kontri.

But di judge rule say di abduction of di separatist leader for di purpose of investigations dey allowed because e already dey face persecution for Nigeria.

Nnamdi Kanu bail application come up

Court no gree grant di Nnamdi Kanu bail wen di application come up during di trial.

Mike Ozekhome, wey be Kanu lead lawyer, move one application for bail.

“Until a pesin dey tried and convicted, e fit dey allowed to waka free,” Mike Ozekhome tok.

Di Senior Advocate remind di court say defendant suppose enjoy di presumption of innocence until proven guilty.

But Shuaibu Labaran, Nigerian goment lawyer wey be di prosecution counsel, pray di court to refuse di application.

Charges wey remain against di Biafra activist

Count 1: Say Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to intimidate di population.

Count 2: Say Nnamdi Kanu as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to threaten members of di public wit sit at home order.

Count 3: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e declare imsef as member and leader of Ipob, group wey Nigeria goment don ban.

Count 4: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage members of di public to kill Nigeria security officers.

Count 5: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage di public to attack officers of di Nigeria police force.

Count 13: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage members of di public to burn down evri federal goment facilty for Lagos wey lead to major economic loss to federal goment.

Count 15: Say Nnamdi Kanu import Radio transmitter known as Tram 50L and hide am inside container for Ubulisiuzor for Ihiala Local government area of Anambra state.