Bamise Ayanwola death: ‘E transfer N3,000 to my account afta e rape me’ – Witness

Trial of Andrew Nice, di BRT driver wey dey face accuse for di death of di young Lagos fashion designer Bamise Ayanwola continue on Tuesday, May 9, 2022 before Justice Sherifat Sonaike court Lagos Island.

One witness for di ongoing trial of alleged killer of Bamise deny accuse say she permit di driver to involve wit her sake of di moni wey dey involved. She tell di court say e rape her.

Dis dey come up afta counsel to di BRT driver accuse di witness say dem sabi demsefs before and na enjoyment dem go enjoy dat evening. Say Andrew Nice no rape am.

Andrew Nice dey face criminal charges wey include rape, conspiracy and murder before di Justice Sonaike court for Lagos Island.

Di first witness wey be woman (name withheld) bin don tell court on Monday say di driver hold knife for hand and rape her for November 2022 inside di BRT bus.

Wen di trial continue on Tuesday, defence counsel cross examine di witness and accuse am say na sake of say di accused no pay am complete make am wan take revenge.

Di lawyer tell di accused “di driver bin promise you 5000 Naira but wen una finish, e give you 3000 Naira wey make you vex, na im make you wan come testify “.

Di witness deny am say e bin no sabi who di driver before dat day.

Wen di lawyer ask am wetin e use di moni do, she reply say “I use POS withdraw di moni, dem minus 100 Naira. I give di rest to beggars for dat Ajah area”.

Di lawyer ask di witness so you give di accused your account number and phone number?

“I give am my account number and phone number because e no let me go” na so di witness reply.

Di lawyer also ask am why e no raise alarm wen di driver dey allegedly commit di act, she reply say di driver hold knife and also hold her to di neck.

Wen di lawyer ask am why e no raise alarm wen di driver free am and even di next time e sight am.

Di witness say “if I tell you like dat you go believe me”?

Di judge discharge di witness.

Andrew Nice dey accused of rape and murder of Bamise, oda charges include conspiracy.

Wen di mata come up on Monday, di prosecution also add one more count charge against am wey make di total charges five counts.

Di suspect Andrew Nice plead not guilty to di whole charges wey dem sama am.

Justice for Tina: ‘She be 17 going on 18 and bin get many dreams’
The British Broadcasting Corporation

Wetin di second witness tok

Second witness for di case na Kayode Aluko wey be one of di fleet operations manager for Lagos Bus Service Limited.

E confam say e sabi di accused Andrew Nice say e be driver from Excel outsourcing company.

E confam say dem allot bus 271 to am on di 25 November 2022 and on di 29th December 2022 dem allot same bus to am.

On February 26 2022, dem allot bus 240257 for afternoon shift. Dis na di date Bamise enta di BRT bus and disappear.

Mr Aluko tell di court say na until February 28, 2022 na im di report reach am from di family of di deceased.

Say di family give di bus number as bus 240257 and wen im check, di number rhyme wit dia bus and na di suspect drive am, but im no dey around dat moment.

“Di suspect resume work around 2pm, I tell am to see me once im arrive. E tell im outsourcing company say im wan go eat but e no come back again” na wetin di witness tok

Mr Aluko say wen im leave, dem go out to Ogolonto Ikorodu area wia di driver dey live to go find am but no find am. Say im no respond to im phone plenti times dem call am.

E add say “Di suspect later call back to tell im company say e dey hospital “.

Di judge Sonaike adjourn di case to June 1, 2022 for continuation.

Bamise elder brother Pelumi wit her elder sister Damilola carri banner come court to show how di mata dey vex dem.

Lawyer to di Bamise family Adesina Ogulana tell BBC Pidgin afta di court session say dem still no happy say di state goment use dia hand to prosecute di mata, say di family prefer make private hands prosecute am to avoid any kind of collaboration as di accused and di prosecution team dey for same side.

Sylvester Oromoni wey die afta dem allegedly beat am sake of e no join cult tok how e die
The British Broadcasting Corporation

Witness tell court say BRT driver rape am wen di prosecution cross-examine her

Di witness for di case, bin tell di court on Monday say di driver, di accused bin rape am inside di BRT bus earlier before di Bamise mata happun.

Di lady (name withheld) wey be mother of one, tell court say she enta di bus afta work, but before dem go reach her bus stop, na only she be passenger wey remain inside di bus.

“Di driver begin make advances on me, but wen I no respond well, e comot knife threaten me” na so di witness tok.

She tell court say di driver say e go fit kill and dump am, say nobodi go fit find wia her body dey. She say di incident happun on November 25, 2021 along di Ajah axis of di city.

“E tear my cloth, rape me from di back. E collect my account number send me 3000 say make I use am buy pain killer” na wetin di witness tok.

Di witness present di cloth wey she wia dat day wey di driver allegedly used small knife tear before e rape am. Di court collect di cloth as exhibit 1.

Court adjourn di case to Tuesday May 10 for continuation. Di defence team dey expected to cross examine di witness wen di case resume.

Wetin happun to Bamise

Bamise na young fashion designer from Ondo state but bin dey live wit her parents for Lagos. She bin dey on her way to see her elder brother wen she miss.

She di last born of di Ayanwola family. She stop school to venture into fashion designing. She just do freedom from wia she learn work before her untimely death happun.

Tori be say police discover her deadi bodi for di streets of Lagos days afta she go missing wen she enta BRT bus wey dey owned by di goment.

Her family say she do video recording of part of her experience inside di BRT bus and also send SOS messages to her friend wey help her family and security agencies sabi which bus and driver wey dey involved for di mata.

Tori of her death cos plenti gbas gbos for Lagos and for social media.

Police arrest di driver of di bus she enter Andrew Nice and carri am go court. Court remand am for over two months before im trial begin on Monday, May 9, 2022.

Di incident lead to di withdrawal of BRT buses on all di Lagos routes a day afta police discover her bodi. Dem however resume work di next day.