Aston Villa vs Arsenal: Bukayo Saka goal give Arsenal 1-0 victory over Aston Villa

Saka scores

Getty Images

Bukayo Saka grab di only goal of di game as Arsenal bounce back from Wednesday defeat as dem beat Aston Villa 1-0.

Di Gunners now dey four points clear of Manchester United wey dey behind dem for di Premier League table.

Saka shot from just outside Villa eighteen beat Martinez to give Arsenal di lead on 30 minutes.

Di Englishman goal na im ninth for di season, equal wit Arsenal top scorer Emile Smith Rowe.

Villa bin struggle to create much during di game as dem no shoot any shot on target until afta 90 minutes.

Arsenal bin control much of di match but di game bin lack big opportunities but di Gunners go be di happiest as dem no get 54 points wit one more game in hand ova dia rivals.

Second half

46 mins: Arsenal restart di second half as dem lead Aston Villa 1-0.

48 mins: Arsenal win dia third corner kick of di match as Cedric shot hit Young. From di corner, Smith Rowe manage to shoot, Martinez save di shot.

51 mins: Arsenal launch anoda attack afta Lacazette pinch di ball from McGinn. Saka find Ordegaard wey shoot but Villa defenders blockk di shot go out for corner. Villa clear di cross from Arsenal corner kick.

55 mins: Di crowd for di stadium don begin dey ginger as dem want dia side to create something. So far, Villa neva shoot any shot at all.

57mins: Yellow card for Cedric Soares. Di Arsenal man pull Ashley Young shirt afta im dribble am. Di freekick from Coutinho dey too much for Cash to meet am.

61 mins: Villa finally make attempt as McGinn look to curl im shot past Leno but di curl bin dey too much as di ball go wide.

64 mins: Saka replicate wetin McGinn bin do but dis time wit im favourite left foot but di bend on di ball bin no dey enough for di shot to dey on target.

65 mins: Yellow card for Thomas Partey wey foul Cash. Douglas Luiz blast di freekick high and over di bar.

Both teams don dey prepare to make dia first substitution.

68 mins: Hit di post! Ollie Watkins shot take deflection off White, di ball hit di post as Leno look like say im dey relieved.

69 mins: Substitutions – Villa bring ON Bailey and Traore for Ramsey and Buendia.

While Arsenal send ON Pepe for goalscorer Saka.

75 mins: Aston Villa neva shoot any shot on target so far as di match remain 15 minutes plus added time.

Meanwhile e look like say Arsenal wan tak off Lacazette as Nketiah dey warm up.

77 mins: Substitution – Nketiah ON, Lacazette OFF.

81 mins: Villa make dia last substitution as Ings don replace Watkins.

85 mins: Villa create anoda chance as Ings rise high to nod Young cross just over di Arsenal post.

86 mins: Mikel Arteta make im final change. Martin Odegaard don comot, Rob Holding don enta.

89 mins – Leon Bailey send in dangerous cross, Tierney no dey sure wia di Villa attacker dey so im head di ball go out for cornerkick. From di corner, Villa player head di ball go off target.

90+1 mins: Referee Andy Madley don add four extra minutes. If Villa need one point from dis game dem need score now while Arsenal need hold on to consolidate on fourth position.

90+3 mins: Aston Villa now don begin send in crosses into Arsenal eighteen. One of dem fall for Traore wey head wide.

Full Time: Aston Villa 0-1 Arsenal

First Half

Players don come out for pitch and we dey ready to start.

1 mins: Villa na dem take di first kick of di game.

Di Villa Park stadium dey full and dem dey cheer di home side on for di early stages of di game.

3 mins: Smith Rowe don blaze im shot over di bar as Arsenal create di first chance of di match.

Di move come as a result of Saka quick break, im find Odegaard wey pass give Smith Rowe but di Englishman shot dey overhit.

6 mins: Saka try to dribble past Mings to create opening for imsef but di defender hold am off well come clear di ball.

10 mins: Arsenal create anoda chance for demsef as Partey shoot Odegaard pass first time.

Martinez catch di Ghanaian shot wit ease.

Soon afta, di goalkeeper react quickly to stop Konsa from scoring own goal as di defender mistakenly deflect di ball go towards im goal

15 mins: Ball Possession so far Aston Villa 39% – 61% Arsenal

Yellow card for Ramsey. Di Aston Villa man foul Smith Rowe and referee Andy Madley show di midfielder card.

21 mins: Ben White need dey alert to clear dangerous ball into di Arsenal eighteen. Leno rush out to catch di loose ball.

28 mins: Villa threaten Arsenal wit corner kick but Leno catch di cross well before im hit Tierney wey lie down for ground. Afta some seconds, di Arsenal left back stand up.

29 mins: GOAL! Bukayo Saka give Arsenal lead. Di Englishman shoot through plenty players wey bin dey inside Aston Villa penalty area. Martinez hand touch am small but im no fit stop am.

32 mins: Yellow card for Mings wey foul Saka. Arsenal players surround di referee as dem ask for Red but instead di Ref show McGinn yellow too as im push Lacazette.

40 mins: Wit less dan five minutes before half time, Villa neva shoot any shot so far.

While Arsenal get four shots, two of dem don dey on target.

45 mins: Yellow card for Granit Xhaka. Di Arsenal man foul Cash but na im reaction to di referee na im make di ref show am card. Three minutes, na im referee Andy Madley add before half time.

45+3 mins: Arsenal goalkeeper Bernd Leno rush out to catch Villa cross into di box, di Arsenal man look like say im bin injure but im dey okay.

Half time: Aston Villa 0-1 Arsenal

Aston Villa vs Arsenal line up

Aston Villa lineup: Martinez, Cash, Konsa, Mings, Young, McGinn, Douglas Luiz, J Ramsey, Coutinho, Buendia, Watkins.

Arsenal lineup: Leno, Cedric, White, Gabriel, Tierney, Partey, Xhaka, Saka, Odegaard, Smith Rowe, Lacazette.