Willie Obiano arrested: EFCC say why dem arrest former Anambra state govnor hours after e hand over give Soludo

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don arrest di former Govnor of Anambra state Willie Obiano.

Im arrest dey come di same day e hand over give Govnor Charles Soludo.

Tok-tok pesin for EFCC Wilson Uwujaren confam give BBC Pidgin say dem arrest am and e dey dia office for Lagos state, South West Nigeria.

According to reports, di former govnor bin dey on im way to Houston, Texas for United States afta im handover power to im successor, Governor Charles Soludo.

Speaking on why dem arrest am, Uwujaren say im bin don dey dia watchlist since but dem bin no fit gbab am becos immunity bin cover am.

“E bin don dey our watchlist for sometime now. If you dey on di watchlist e mean say we dey look out for you. Before now e get immunity, E lose di immunity today and e bin wan leave di kontri so we pick am.” Na so Uwujaren tell BBC Pidgin.

E no dey clear for now why di commission get am for dia watchlist based on di allegation against am.

In di past many Nigerian ex-governors don face arrest soon after dem leave office and face prosecution for corruption – mostly money laundering.

Earlier in di day, di former Governor wife bin involve for faceoff with di widow of former Nigerian separatist leader Odumegwu Ojukwu.

Several videos wey don go viral on social media show di two women stand toe-to-toe as dem exchange words and show aggression for di venue where Mr. Obiano bin hand over power to newly elected governor. But e no dey clear wetin cause di quarrel.

Wetin to know about Willie Obiano

Born on 8 August 1955, Obiano serve two terms as governor of Anambra State between 17 March 2014 to 17 March 2022.

Di 66-year-old na graduate of Accountancy from di University of Lagos for 1979.

Im also get Master for Business Administration from di same university.

Before im enta politics, Obiano na former banker wey also don serve as accountant for Chevron Oil Nigeria Plc.

Im bin contest for di governorship seat wey im win for 2014 under di All Progressives Grand Alliance, APGA.