Coronavirus update: Nigerian states wey never get confam case of Covid-19 – How dem dey prevent am?

Isolation centre

BBC
Dangote don arrange six hundred bed isolation centre or Kano State

As at January 12, 2020, na only China get confam case of Coronavirus but by January 13, di virus don become global problem, as kontris like Thailand, Japan, South Korea and America begin record dia first cases of di virus.

Afta den, di disease begin spread to oda part of di world, including Africa.

For now, more than 2.15 million confamed cases of Coronavirus na im dey di world.

Nigeria bin record di first case of Covid-19 for February 27, afta one Italian man wey enta di kontri test positive for di virus.

For March 9, di kontri confam di second case, one citizen wey get contact wit di Italian man test positive.

Afta den, di kontri begin record more cases.

According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give, di kontri get 442 confamed cases of di virus and e don enta 20 states of di federation.

CASE SUMMARY FOR NIGERIA AS AT 16th APRIL 2020

  • Total Samples Tested – 6649
  • Total Confirmed cases – 442
  • Discharged – 152
  • Death – 13

States Affected

No. of Cases (Lab Confirmed)

No. of Cases (on admission)

No. Discharged

No of Deaths

Lagos

251

154

90

7

Abuja FCT

67

42

23

2

Kano

21

20

0

1

Osun

20

3

17

0

Edo

15

9

5

1

Oyo

13

8

5

0

Ogun

9

4

5

0

Katsina

7

6

0

1

Bauchi

6

6

0

0

Kaduna

6

6

0

0

Akwa Ibom

6

3

3

0

Kwara

4

4

0

0

Delta

4

3

0

1

Ondo

3

3

0

0

Enugu

2

0

2

0

Ekiti

2

1

1

0

Rivers

2

1

1

0

Niger

2

2

0

0

Benue

1

1

0

0

Anambra

1

1

0

0

Total

442

277

152

13

Di states wey Covid-19 neva enta

As di Coronavirus dey spread and kontris for the world dey record high numbers, about 16 states for Nigeria still dey free.

  • Gombe
  • Adamawa
  • Plateau
  • Borno
  • Ebonyi
  • Cross River
  • Sokoto
  • Kebbi
  • Imo
  • Bayelsa
  • Taraba
  • Kogi
  • Nasarawa
  • Zamfara
  • Yobe
  • Jigawa

Some of these states dey di Northern part of di kontri wey get high population and authorities fear say kasala fit burst if dem record any case as health centres for dis part of di kontri no too many.

But since di outbreak of Coronavirus for di kontri, some of dis states don take some steps to ensure say di virus no enta dia states and dey don also prepare to contain di virus in case e happun.

Coronavirus cases: How Oluwaseun Osowobi take survive Covid-19 for Nigeria
The British Broadcasting Corporation

Borno state set up 25 man Task Force wey go partner wit private sectors, faith based organizations, NGOs, and oda agencies to manage di virus in case e enta di state.

On 19 March, Anambra State goment announce say make all schools for di state close, dey also suspend any kain public gathering till further notice.

For 21 March, Kebbi State say make all schools for di state close till further notice.

For 23 March, Ebonyi state goment ban all public gatherings, whether na wedding, burial, seminar, any tin wey go make plenty pipo gada.

Young Pipo fit catch coronavirus?
The British Broadcasting Corporation

Bayelsa and Imo state give order say from March 26 make all schools for di states close and dem ban public gatherings wey pass 50 pipo.

Abia State announce border closure for four weeks, and order say make residents sidon for house, dey close markets and only pipo wey dey sell food items and melecine go open shop.

Cross River goment ban all religious gatherings wey pass more than 5 pipo.

Kebbi no gree make pipo comot or enta di state.

Nigerians tok dia mind on top coronavirus wey enta dia kontri
The British Broadcasting Corporation

Taraba goment close all dia borders and restrict movement to enta or comot for di state.

Oda states for di federation wey get high number of confam cases, Lagos, Abuja and Ogun states dey under lockdown for 14 days and oda states wey di virus don enta don put measures in place to take contain di spread.

Kwara State wey just confam dia first two case, dey under partial lockdown.

We don update dis tori

BBC Pidgin Covid 19 graphics

BBC