Timothy Adegoke murder: Court remand Rahman Adedoyin, suspects of OAU student death

Osun state high court don order di remand of Rahman Adedoyin and six oda pipo wey dey stand trial for di murder Timothy Adegoke for Ilesa correctional facility.

Di presiding judge wey also be di Chief Judge of di state, Oyebola Adepele-Ojo make di order on Thursday during di arraignment of di suspects.

Di suspects dey face 11 count charge wey dey bother on conspiracy and murder. although all of dem don plead not guilty.

Dia Lawyer Rasheed Adegoke ask di court to keep dem for police cos of di states of Nigerian Prison but di Judge decline

Di court resume again tomorrow to hear bail application of one di defendants and trial dey expected to start fully next Monday as di Presiding judge tell di court say she wants a speedy trial.

Na since November 7, 2021 di OAU masters student, Timothy Adegoke go missing.

Police later find Adegoke deadi bodi about one week afta dem declare say im dey miss.

Security dey tight for the Osogbo high court earlier Thursday morning sake of di case.

Before now, Federal High Court for Abuja bin strike out one murder case for Timothy Adegokeon 8 February, 2022.

Dis as prosecuting counsel, Ochogwu Ogbe bin ask so dat dem go fit do more investigation.

Di lawyer of di Adegoke family, Femi Falana bin ask make dem try di suspects for Osun state and not Abuja.

Who be Timothy Adegoke and wetin happun to am

Before im death, Timothy Adegoke na postgraduate student of Obafemi Awolowo University, Ile Ife.

Di 37-year-old man wey dey live for Abuja bin travel to Ile Ife on November 5, 2021, to write one examination for di school distance learning centre for Moro, Osun State.

Adegoke family declare am missing afta dem no fit reach am and e no show up for di exam wey e go write for di school.

Police find Adegoke deadi bodi about one week afta dem declare say di man dey miss. Dem arrest di owner of di hotel wia Timothy Adegoke bin lodge before dem declare am missing.

Wetin else don happun so far

  • Tori be say dem declare Timothy Adegoke missing on November 7
  • Adegoke, wey be Abuja-based student, bin travel to Ife on November 5 to write one examination for di school distance learning centre for Moro, Osun State
  • Im family and friends begin worry wen dem no fit reach am and as e no show to write di exam.
  • Police find di deadi bodi of Timothy Adegoke, about one week afta dem declare say e dey miss
  • Police arrest Dr Rahman Adedoyin, owner of di hotel wia Adegoke bin lodge before e miss and six oda suspects ontop di mata.

Who be Dr Rahman Adedoyin, di main suspect for di case?

Dr Rahman Adedoyin na di owner of di hotel, Hilton Resorts wia Adegoke bin lodge.

E be educationist and businessman wey be di founder and proprietor of Oduduwa University and The Polytechnic, Ile-Ife.

Dem born Rahmon Adedoyin into royal family for di ancient city of Ife in Osun State.

Na for Osun state e complete im primary and secondary school education before e proceed to University of Ife (now Obafemi Awolowo University) wia e obtain a Bachelor of Science degree in 1983 afta e study Mathematics Education.

E get im doctorate degree for 1996 from All Saints University School of Medicine, New York City.

E also be fellow of di Nigerian Institute of Industrial Statisticians.

E dey stand trial alongside six odas , Adedeji Adesola, Magdalene Chiefuna, Adeniyi Aderogba, Oluwale Lawrence, Oyetunde Kazeem, Adebayo Kunle, for di murder of Timothy Adegoke.